You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
'Wen di time come I go marry' - Amaryar Tik-tok
Published
Read am in 1 mins
Hafsat Tuge wey pipo also sabi as 'Amaryar Tik-tok' na one of di Kannywood actresses wey don grow popular for di film industry.
She siddon for interview wit BBC Pidgin to tok about her journey, debunk some issues and touch on other societal pressures against female artistes including around marriage.