Wetin President Tinubu really promise Nigerians about electricity for im 2023 election campaign

Collage of President Bola Tinubu wit one electricity pole
Published
Read am in 7 mins

Di All Progressives Congress (APC) Presidential Campaign Council dey defend di campaign promise wey Nigeria President Bola Tinubu bin make bifor e enta office for 2023.

One of di president 2023 campaign promise na to end estimated billing and to also make sure say electricity supply for Nigeria dey steady.

But di APC campaign council say di opposition don take di tok out of context.

Dem make dis position afta opposition party presidential candidate for di African Democratic Congress (ADC) Atiku Abubakar criticise am say e fail to fulfil im campaign promise to provide Nigerians wit steady electricity.

Di ADC Presidential Campaign Council drag president Bola Tinubu sake of say promise wey e bin make to end estimated billing for electricity.

But wetin President Bola Tinubu really promise Nigerians for 2023, electricity follow?

President Bola Tinubu 2023 campaign promises on electricity

For one document wey e title 'Renewed Hope 2023, Action plan for a better Nigeria' President Bola Tinubu write di tins e go do for Nigeria inside di document wey get 80 pages.

E tok about National security, education, agriculture, power, oil and gas, transportation, health, digital economy, sports and oda tins.

Inside di document, e tok about Power-electricity inside page 30-32 wit di title;

'Power di way to a brighter Nigeria' e say dem no go fit solve Nigeria power problems overnight, but give assurance say dem go put in dia best to solve immedia challenge.

"We go immediately take di necessary steps to make sure say more of di power we already dey generate fit dey transmitted and distributed to Nigerian homes and businesses."

For im long term plan for electricity, oga Tinubu say im go seek to implement further reforms to put nation on track to sufficient on-grid generation, transmission and distribution to power di bright Nigeria of our dreams.

E also promise Off-grid and renewable power generation options and solutions

wey pipo for private sector dey willing to do.

"Our administration go will work wit di private sector and interested state. Govments go provide access to low cost finance for power projects, e tok"

Estimated billing: Concerning estimated billing, oga Tinubu promise to remove am kpatakpata.

"We go end dis unpopular and harmful practice and ensure all electricity bills dey meter-based."

E explain say dem go achieve am by streamlining and make existing schemes like di National Mass Metering Programme and di Meter Asset Provider Scheme to work sharp-sharp.

'We go seek to ensure say all electricity connections dey properly metered wit di shortest time frame. We no go permit new connections to light from di Grid unless dem don install di meter finish."

Solar Energy: President Tinubu explain say im administration plan on solar energy na to focus on all major parts of di power value chain to ensure say pipo take advantage of all di solar power resources dem get to offer, in terms of generating, transmitting and distributing residential solar power solutions.

Domestic Manufacturing of Electricity Meters: E also tok about support for domestic manufacturing of Electricity Meters, wia e promise say im govment go reduce import levies on manufacturing

"We go streamline and relax regulations to enable private sector, local and state

govment actors to electrify rural Nigeria in safe and secure manner wit reasonable tariffs.

Nigeria First Power Policy: On dis, e say dem go direct gas resources as di number one priority to Nigerian power generation. "We go work wit di National Assembly to review di Electric Power Sector Reform Act 2005 and reform di regulatory and governance structure of our nation power sector."

Na all dis promises President Bola Tinubu bin make as e dey campaign for di 2023 election.

Opposition now don dey use di promise drag am and accuse am say e no fulfil im electricity promise to Nigeria.

Former Nigeria Vice President Atiku Abubakar wey also be di presidential candidate of di ADC for 2027 election say "Tinubu electricity excuse no go fit light single home".

For one statement wey Phrank Shaibu, Director of Strategic Communication of di ADC Presidential Campaign Council issue, Atiku say make di APC stop to dey celebrate paperwork, while pipo dey inside darkness for dia homes and businesses.

"Afta three and half years, families still dey struggle to get light for dia homes. Traders and small business owners dey spend scarce resources on alternative power, yet struggle to keep dia businesses alive. Authorities dey bill Nigerians for electricity wey dem no go fit rely on. President Tinubu bin promise steady power and to end estimated billing. E neva keep dat promise yet."

Atiku also outline di electricity bands wey Nigerians fall put depending on di number of hours dem dey get light in one day.

"Across Nigeria, dem place consumers for Bands A, B, C, D and E and dem dey charge different rates. For many areas, Band A customers dey pay about ₦209.50 per unit bifor VAT. Rates for di oda bands dey different by state and electricity provider. Yet across evri band, di same hardship dey: di power dey fail, but di bill dey come. No family suppose weigh di cost of electricity against di cost of food. No business ssuppose pay more wen dem dey receive less."

Oda tins Atikun tok about na

"Di govment plan to end electricity subsidies from 2027, even as dem insist say immediate tariff increase no go dey."

Im add say wen President Tinubu bin campaign for 2022, in bin make unmistakable commitment. im tok say : 'If I no give you constant electricity for four years, wen I come back for second term, no vote for me."

According to Atiku Nigerians don pass through di four years. Dem no need im campaign council to interpret im words for dem. Dem need am to answer for dem."

'Ova 1.5 million customers get meter under di Presidential Metering Initiative - APC

For APC Presidential council defence, dem say make pipo consider wetin oga Tinubu bin tok dat time in full context.

Di council say na for one meeting wit members of di Organised Private Sector (OPS) for Lagos ahead of di 2023 general elections na im Bola Ahmed Tinubu bin tok about how im go tackle some of di institutional problems wey Nigeria power sector don face for more dan five decades.

According to Dele Alake wey be di tok-tok pesin for di council, e say di presidential candidate exact words at di time na "Whichever way, by all means necessary, you go get electricity, and you no go pay for estimated bills anymore. A promise made go be a promise kept. If I no keep di promise and I come for second term, no vote for me, unless I give you adequate reasons why I no fit deliver."

Oga Dele say dem still dey fix di power sector crisis wey neva finish. E say di president dey work consistently to deliver on im promise to Nigerians, and im commitment to face di challenges head-on neva reduce.

E highlight some of di tins wey President Tinubu don do for di power sector wey include:

Signing di Electricity Act, 2023 on June 9 - Di act liberalise and deregulate di power sector, wey move am from di exclusive list so dat states and sub nationals go fit participate for power generation, distribution, and transmission wey states like Lagos, Enugu, Abia, Ekiti, Oyo, Kaduna and Niger dey take advantage of.

President Tinubu bin take ova N6 trillion legacy debt wey bin accumulate from 2015 to 2025.

E start di Presidential Metering Initiative to close di ova 7 million Metering gap.

Dele Alake add say in di last three years, ova 1.5 million customers don receive meter under di Presidential Metering Initiative.

Di Rural Electrification Agency don also connect universities, hospitals, and rural communities to solar power.

Di administration create N4 trillion bond programme to settle verified legacy debts to 21 power generating companies (Gencos) and gas companies (Gascos).

E say dem still dey fix di electricity market and power sector and President Tinubu neva comot one inch from im commitment.

Wetin be di reality on ground for Nigeria

Wetin Nigerians dey face be say, for some states and areas light dey while some oda parts no dey too get light.

Di national grid still dey collapse up and down, for 2026 alone, e collapse pass six times and Nigerians still dey ask why National Grid dey collapse evritime

Nigeria for some areas dey use meter, while some pipo still dey use estimated billing.