Mozambique citizen wey carry bomb enta South Africa chop 10 years prison sentence

Wia dis foto come from, Alexandra BEIER / AFP via Getty Images
One foreign national wey attempt to carry bomb enta South Africa through Lebombo port don dey sentenced to 10 years for prison.
Twenty-six-year-old Antonio Charles Mugabe from Mozambique chop jail term as e plead guilty to di three charges wey di Directorate for Priority Crime Investigation (DPCI) bring against am.
Di Boschfontein Regional Court sentence am on Monday, 26 October on charges wey border on possession of explosive device, transportation of explosive device and importation of explosive device into di Republic of South Africa.
According to South Africa police, dem arrest Mugabe for di port of entry as dem discova di "60 mm mortar bomb, one military-grade explosive device" wey e hide for im luggage.
"While scanning luggage wey belong to di accused, officials bin identify one suspicious object e hide inside im travel bag," police tok for statement.
Dem say di bomb pose serious threat to public safety and national security.

Wia dis foto come from, Bloomberg via Getty Images
Na for August dem arrest Mugabe, during one joint border operation wey di police and di South African Revenue Service carry out routine screening and inspections of travellers wey dey enta di kontri from Mozambique.
Mugabe arrest dey come following wave of protests against immigrants for South Africa dis year, and some of dis protests don turn violent wey don lead to killings and looting of property.
Di protesters demand na for all undocumented migrants to leave dia kontri.
Just few days ago, about 50 pipo for Durban bin beat one foreign national to death, South Africa police tok.
According to police, two men bin approach di unidentified man, wey dem believe say dey im late 30s or early 40s, by di roadside bifor one larger group begin assault am. Dem declare am dead for di scene.
Also, earlier dis month, unknown pipo bin set fire on shops for Durban, as well as Soweto, near Johannesburg.
Di govment don advise demonstrators to act peacefully, as dem also accept di need for immigration reforms.
Govment say dem don deport or repatriate tens of thousands of foreign nationals since dem launch one crackdown earlier dis year.
One of di groups behind di protests, March and March, bin also set one deadline of 30 June for all undocumented migrants to leave South Africa.
Several protests bin hold ahead of dat deadline, wit reports of attacks on pipo from oda African kontris.
Dis don make several kontris including Nigeria, Ghana, Zimbabwe, and Mozambique, to take steps to repatriate dia citizens for di middle of fears of further violence.
Nigeria bin accuse South African authorities say dem dey responsible for di death of some of dia citizens wey kpai sake for di months wey di kasala dey hot.
Ghana also confam di death of one citizen, Bashiru Isak, one father of three wey dem shoot dead for Cape Town during demonstrations wey target foreign nationals.
More dan three million documented foreign nationals dey for South Africa, according to official figures.
Di statistics no get record of di oda migrants dem believe say dey di kontri witout papers - one bone of contention for di protesters.
Police say dem don arrest about 80,000 migrants since January becos dem dey di kontri illegally.
Many African migrants bin move go South Africa around di time white-minority rule bin end for1994, wit di hope for a beta life.
But as South Africa dey face unemployment rate of more dan 30%, anti-migrant sentiments don rise.



















