Nigeria Minister for Interior cast im vote for ongoin Ondo election
Di minister of interior Olubunmi Tunji-Ojo don cast im vote for di ongoing Ondo state govnorship election.
Tunji-Ojo wey vote at around 11:34am for im area for polling unit 17, Ward 3, Akoko North-West local govment area of di state.
Di minister say di election dey go peaceful.
"Na peaceful election wit officials wey dey display high level professionalism wit encouraging turn out of voters," di minister tok.