You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.

Carry me go di main website

INEC final results show how Gov. Akeredolu sweep Ondo election

Ondo State Governorship Election latest updates from di sunshine state of Nigeria 10 October vote.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Helen Oyibo

  1. Nigeria youth give police dia five demand afta dem dissolve SARS

    As Inspector General of police, Mohammed Adamu dissolve SARS, one Nigerian youth don list five tins wey dem want police oga to do.

    Dis inlude to release all arrested protesters of endsars, justice for all deceased victim of police brutality and compensation for dia families plus odas.

  2. Governor Akeredolu celebrate im victory for Owo afta im win

    Ondo state governor, Oluwarotimi Akeredolu celebrate im re-election win for Owo with im supporters wey dey hail am afta INEC declare am di winnner.

    See photos of how di celebaration waka.

  3. President Buhari congratulate Akeredolu and tell am to serve di pipo beta

    Nigeria President Muhammadu Buhari don congratulate di govnor of Ondo state state, Oluwarotimi Akeredolu on im re-election and want make e use dis second term to serve di pipo of di state beta pass wetin im do for im first term.

    Oga Buhari tok dis one inside statement wey one of im aide on Media and Publicity Femi Adesina sign.

    E advice di govnor to dey humble as e dey celebrate im victory.

    Di president also hail di Independent National Electoral Commission for di credible election dem organize, security agencies wey maintain peace and orderliness for di election and lastly, di pipo of Ondo state for di way dem conduct themselves for di election.

  4. See INEC live results from INEC on who win Ondo Govnorship 2020 election

  5. Breaking, Oluwarotimi Akeredolu don win Ondo election

    Governor Oluwarotimi Akeredolu na im be di winner of Ondo govnorship election.

    Di Independent National Electoral Commission (INEC) declare Oluwarotimi Akeredolu of APC di winner afta e get 292830 vote to beat PDP Candidate,Eyitayo Jegede wey get 195791 votes.

  6. APC win for Ese-Odo

    Ese-Odo LGA

    APC - 13383

    PDP - 4680

    ZLP- 4760

  7. APC carri Ilaje LGA

    Ilaje LGA

    APC -26657

    PDP- 11128

    ZLP- 4405

  8. APC win for Odigbo LGA

    APC - 23571

    PDP - 9485

    ZLP - 6540

  9. , Watch di result collation live

  10. APC win Ondo West

    Ondo West

    APC - 15977

    PDP - 10627

    ZLP - 10159

  11. APC win Okitipupa LGA

    Okitipupa LGA

    APC -19,266

    PDP - 10,367

    ZLP - 10,120

  12. APC win Ose LGA results

    Ose LGA

    APC - 15122

    PDP - 8421

    ZLP - 1083

  13. INEC final collation of Ondo Governorship Election Results

    We dey here for INEC Collation centre for Alagbaka Akure wia INEC officials for di Ondo 2020 suppose resuming announcements of results by 9am.buut as e be some party agents don dey wait.

    So far dem don announce results from 12 local goment results out of di 18 local goment wey dey di state.

    Today di INEC returning officer for di state, Prof Aben Idowu Olayinka go preside on di announcements of di remaining 6 local goment and hopefully declare di winner of di Ondo 2020 govnorship election.

  14. Breaking, INEC don march break

    INEC don march break ontop di announcement of di final results from di local goment areas dem.

    Before di break, dem bin don call 12 local goment areas out of di 18 wey dey di state.

    INEC say dem go return to continue by 9:00am.

  15. PDP win Akure South

    Akure South LGA

    APC- 17277

    PDP- 47627

    ZLP- 2236

  16. APC win Akoko South East and North East

    Akoko South East

    APC-9419

    PDP- 4003

    ZLP-2004

    Akoko North East

    APC-16572

    PDP- 8380

    ZLP- 3532

  17. APC win Idanre LG

    Idanre LGA

    APC-11286

    PDP- 7499

    ZLP-3623

  18. PDP win Akure North

    Akure North LGA

    APC- 9546

    PDP- 12263

    ZLP-1046

  19. APC win Owo

    Owo LGA

    APC- 35957

    PDP- 5311

    ZLP- 408

  20. APC win Ondo East

    Ondo East LGA

    APC-6485

    PDP-4049

    ZLP-3221