You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.

Carry me go di main website

Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Condoms, TB and HIV drugs, 'disappear' from State Agency warehouse for Kenya

    Kenya Medical Supplies Authority (Kemsa) dey on di spotlight again, after hundreds of thousands of condoms, mosquito nets and tuberculosis drugs wey worth reach $100,000 disappear from dia warehouse.

    Global Fund, wey dey finance di fight against HIV/Aids, tuberculosis, and malaria na dem reveal dis one.

    Di Fund also accuse Kemsa of overstating di value of medicines by millions of dollars, with some types of drugs as e don increase by100 times. E dey believed say pipo steal and resell di lost medicines on di black market and to private chemists.

  2. Bandits kill DPO, two officers and four vigilantes for Niger State

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, BBC Pidgin, Abuja

    Armed bandits invade Nasko village for Niger state-North Central Nigeria and kill di DPO Umar Digari, two oda police personnel and four vigilante corps.

    Police tok-tok pesin, DSP Wasiu Abiodun wey confam di incident say di DPO bin mobilise di police operatives and vigilante members to engage di bandits but during di gun battle, di DPO and di officers die.

    Di Area Commander for Kotangora don draft reinforcement wit military personnel to di area to stop any breakdown of law and order.

  3. In Fotos: Russia invasion of Ukraine

    One woman wey dey cry onboard train to Poland, di man wey dey ride bicycle pass one bombed building, tank wey dey patrol street wey pipo no dey.

    Here na some of di most recent pictures of Ukraine.

  4. How di battle for Ukraine dey go?

    Here na a quick summary of Russia attacks based on di latest analysis by di Institute of di Study of War. Di US-based thinktank dey use OSINT and news reports to craft a frontline assessment evri day.

    Kyiv: While Russian forces launch scattered attacks on Irpin and Guta-Mezhyhirksa - areas just outside di capital - on Monday and Tuesday, dem neva take any broader action against di city in di past 24 hours

    Mariupol: Russia continue to attack di southern city from di east and west

    Kharkiv: Russian forces dey struggle wit shortage of ammunition for dia attempt to encircle dis north-eastern city

    Kherson region: Russia falsely claim say dem dey in control of dis region on Tuesday, but dem neva make any advance to either Zaporizhya or Mykolaiv - di key cities

    Odesa: Russia no dey ready yet to launch operation from di sea against di southern port city as dem neva establish troops on di ground here.

  5. Nigerians in darkness as national grid collapse again

    Di collapse of Nigeria national electricity grids don leave many Nigerians for darkness.

    Electricity consumers for Lagos, Enugu, Ibadan, Anambra go live inside darkness as di national grid don collapse again.

    Dis na according to di electricity distribution companies wey dey serve di areas.

    Na di second time in two days wey di grid go collapse.

    Di collapse dey happun at di same time as di kontri dey battle fuel scarcity.

    Dis don make many pipo begin reason alternative source of power for pipo wey dey find stable electricity.

  6. Welcome to Wednesday big news coverage

    Good morning and welcome to BBC Pidgin live-text report of news from around di world.

    Big tori wey dey make di headlines be say:

    • Russia dey continue wit dia invasion of Ukraine as di war don enta day 20.
    • For Nigeria, electricity distribution companies don announce say di national grid don collapse again
    • For Kenya, di kontri biggest transportation union go go on strike today
    • Namibia don announce say wearing facemask no dey compulsory again for public places.

    Make we also sama you wit our proverb for today, e come from Dami Horsefall and e say:

    "Na from black pot white soup dey come out from"

  7. Bye bye!

    Na here we go end today Live Page.

    We don bring you report say 97 children naim don die since di Russian invasion of Ukraine start according to Ukraine's president, Zelensky.

    Woman land behind bars ova accuse she burn her lover pikin nyash.

    Ukraine-Russia war dey make Kenyans pay more for fuel.

    You fit scroll down to read all di tori wey you miss out during di day.

    Na Jelilat, Helen, Ronke, Faith and Tunde bring una all di tori for today.

  8. How many nuclear weapons Russia get plus list of oda kontries wey get too

  9. Russia journalist wey interrupt news wit anti-war placard don chop fine

  10. EFCC arraign man for alleged 19 Million naira fraud, Mohammed Abdullahi Kulloma kolet di money on false pretence

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    Nigeria corruption Police EFCC don arraign one man for alleged N19m fraud for Maiduguri, Northern Nigeria.

    Mr Muhammad Abdullahi Kulloma and Mbuta Criterion Nigerian Limited na im dem arraign before Justice Umaru Fadawu for di Borno State High Court, Maiduguri.

    Na two count chargesdem arraign dem for wey include obtaining Nineteen Million, Nine Hundred and Fifty Thousand Naira (N19, 950,000) by false pretence.

    Di Maiduguri Zonal Command of EFCC, on Tuesday, March 15, 2022, arraign one of di defendant wey use mago-magokolet di money from Abdulwahad Abba Aji, as payment for contract wey dem award di second defendant to supply water pumps to Norwegian Refugee Council, one Non-Governmental Organisation.

  11. Wetin don happun today for Russian invasion of Ukraine?

    In case you just dey join us, see wetin happun on di 20th day of Russian invasion of Ukraine:

    • Ukraine President Volodymyr Zelensky tok say make Ukraine accept say dem no go join Nato. Im say Ukrainians dey adequate and dem understand say dem no be Nato member.
    • During im address to MPs, di Ukrainian president tok say 97 children don die since di Russian invasion of Ukraine start.
    • One woman for Ukraine called Anna Tymchenko bin born her first pikin for inside heavy bombing for her one sitting room without light, running water or even doctor.
    • Ukraine President Volodymr Zelensky tell European leaders for London say dem dey rely for di support of dia international partners and not Nato.
    • As Ukrainian refugees enta three million, 70 buses bin go Sumy to rescue civilians.
    • Di mayor of Kyiv, Vitali Klitschko tok say four pipo die afta airstrikes hit di capital overnight. Klitschko yarn dis one ontop Telegram.
    • Ukrainian President Volodymyr Zelensky bin tell Russian soldiers to surrender.
    • Prime ministers of Poland, Czech and Slovenia bin travel by train to Kyiv for tok-tok wit Ukraine president and prime minister.
    • Di EU bin unveil dia fourth package of sanctions against Kremlin. Dis time di target na luxury goods exports as well as investments for Russia energy sector.
    • Russian missile bin hit more residential building for Kyiv dis morning. Ukraine authorities bin release foto of di damage.
    • Advisor to di Ukrainian president chief of staff, Oleksiy Arestovich tok say e expect di war to end by early May latest, wen Russia run out of money to attack dia neighbour.
  12. Russian TV journalist don resign

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    One ogbonge TV journalist wey dey work for Television station wey Kremlin dey control don resign.

    Di journalist resign sake of di screen protest wey Channel One journalist Marina Ovsyannikova do.

    Vadim Glusker, NTV Brussels correspondent don confam di resignation by state news agency RIA Novosti.

    NTV tell RIA Novosti say Glusker don stop to work for dem “since early March” and say im decision “na sake of health reasons” NTV na di third Television Station wey popular well well and ogbonge gas company Gazprom na im get am and na ogbonge pro-Kremlin.

    Tori still dey fly upandan say Zhanna Agalakova Channel One correspondent for Paris don resign too, but dem neva confam dis one.

    Well tell una before say one news presenter from NTV resign come waka comot from di kontri

  13. Zelensky say make Ukraine accept say dem no go join Nato

    Ukraine President Volodymyr Zelensky don appear to suggest say make di kontri accept say dem no go join di Nato military alliance.

    Di Ukrainian president bin speak for one video conference wit military officials earlier today.

    Im tok: "Ukraine no be member of Nato. We understand am. We be adequate pipo."

    Di president continue: "We don hear for years say di doors dey open, but we also hear say we no fit join. Na di truth and e gass dey recognised.

    "I dey glad say our pipo don dey begin to understand am and rely on diasef and our partners wey help us.”

    Before di invasion, Vladimir Putin bin don demand say make dem ban Ukraine from ever joining Nato, as one of di “security guarantees” Moscow bin dey seek.

  14. 97 children don die since Russian invasion of Ukraine - Zelensky

    During im address to Canadian MPs, Zelensky say almost a hundred pikin don die during Russian's invasion of Ukraine.

    Ukraine's president tok say di southern besieged city of Mariupol don dey without communication networks and dey nearly running out of food.

    Zelensky add say 97 children don dey reportedly killed since di war begin

  15. Ukraine war: Baby Alisa come di world as bombing bin dey go on outside

    21 year old Anna Tymchenko bin born her first pikin for inside heavy bombing for her won sitting room without light, running water or even doctor.

    Tori be say as dem bin dey born di pikin afta Russian soldiers hold dia doctor, baby Alisa bin dey blue and dem need to slap am plenti times before she start to cry.

    She bin dey stay for one town wey dem dey call Bucha, with her husband and brother,

    Di town dey close to di Ukraine capital Kyiv and don suffer severe bombing since di war start.

    Because of dat, Anna, her husband and brother bin dey stay for di basement of her apartment, till dey take di light and di place become very cold.

    Na so dem return back to dia house afta attempt to run comot di town meet Russian convoy hold up.

    So dem go back house to born her first dauhter with candles for light and cold water wey dem fit get from inside bottles.

    Anna say she and her pikin dey fine as dem don fit reach di capital of Kyiv tow days afta she born, however dem no fit leave di kontri, and dat one dey fear here.

  16. Suspected thief chop arrest afta im sleep off inside di car e break into

    One man wey fall asleep for inside di motor wey im allegedly break into don chop arrest for Phoenix, north of Durban for South Africa on Monday.

    KwaZulu-Natal VIP Protection Services’ confam di incident for one Facebook post say dem find di man dey sleep inside di motor for Kranpalm Close for Palmview.

    “Na resident wey see say pesin don break into di car alert us. Dem see di suspect dey sleep inside di car afta im allegedly attempt to tiff valuables,” dem tok.

    KZN VIP Protection Services say dem detain di man and hand am over to di police.

  17. Di Nigerian doctor wey dey try to help Africans for Ukraine

    Nigerian Dr Awofaa Gogo-Abite don live for Ukraine for 14 years.

    Im work as a surgeon and lecturer. Im run from di kontri sake of di war and feem im jony to Poland.

    For interview wit BBC, e share im experience about di racism im face for border and how im wan help others wey dey face di arduous journey.

  18. woman wey allegedly maltreat lover pikin dey behind bars- Kogi goment

    Kogi State goment don order di arrest and prosecution of one woman, Elizabeth Abu, wey allegedly maltreat her lover pikin and burn im nyash.

    Di state Commissioner for Women Affairs and Social Development, Fatima Buba, order di arrest afta di governor, Yahaya Bello order say make dem arrest her afta video of wetin she allegedly do di boy go viral

    Madam Buba say dem don charge madam Elizabeth to court and dat di pikin dey hospital dey receive treatment for Specialist Hospital for di capital.

    She explain give say di woman claim say di pikin dey stuborn and dat e tear im school uniform to take use do duster and she decide to use cable to beat am and dat she no use hot iron to take burn di pikin for nyash.

  19. Weapons wey una dey send dey finish in a few hours - Zelensky

    Ukraine President Volodymr Zelensky tell European leaders for London say dem dey rely for di support of dia international partners and not for Nato.

    E say, "of course, Ukraine no be Nato member, we sab am. We don hear for plenti years about open doors, but we also sabi say, we no fit enta those doors".

    E say make oda kontris wey dey di border of Russia, make dem dey tink dia "independent defence capabilities" outside Nato.

    Zelensky also tok about oda tins for im address like:

    • E say di shipments of Supplies wey UK and oda nations dey give dem dey quick finish: "Di amount wey dey get per week, in 20 hours e don finish".
    • Because of dat, dem dey use captured Russia equipment and old Soviet-era kit.
    • E say di Western sanctions na beta tin but e no dey enough to end di Russian gra-gra and dey ask make dem sama full trade embargo.
    • E call out companies wey still dey do business for Russia.
    • E also call for di barring of Russian navy vessels from ports around di world, and make dem ban Russian banks from di Swift financial messaging system.
  20. 70 buses dey go Sumy to rescue civillians, as Ukraine refugees enta three million

    Di Red Cross wan evacuate civilians comot di north-eastern city of Sumy, as heavy shelling still dey shele, with 70 buses wey go land for two convoys two.

    Tok-tok pesin for di organisation say di mata also bad for di southern port city of Mariupol, wa pipo "dey suffocated for di city without any aid".

    Dis dey come as di number of pipo wey dey run comot from Ukraine don enta three million, according to UN, with around 1.8 million wey dey for POland.

    Unicef don hala say almost half of all di refugees na pikin dem be, wey fit mean say every second, one Ukrainian pikin go turn refugee.

    Plenti of di refugees no get any family ofr Europe, no get wia to go and don dey traumatised by wetin dem don take eye see.