You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
Live Coverage
Una bye bye for now!
We go end today Live Page here.
So far, we bring you report say Lagos state court don remand Bus Rapid Transit (BRT) driver Andrew Nice for prison custody till April 11.
Russian President Vladimir Putin don call for foreign volunteers to dey allowed to fight against Ukrainian forces.
Ghana hold mass burial for some 13 victims wey die after mining truck explosion hit Appiatse community for Western Region.
No forget to scroll down to read all di tori wey you miss out during di day.
Na Faith, Helen, Ronke, and Moseph bring una all di tori for today.
Bamishe Ayanwole murder: Court remand BRT driver for prison
Di magistrate court for Yaba, inside Lagos don remand Bus Rapid Transit (BRT) driver Andrew Nice for prison custody till April 11.
Andrew na di BRT driver wey carry di late 22-year-old Bamise Ayanwole from Chevron, Lekki to Oshodi on Saturday, February 26 before dem declare her missing.
Di 47-year-old driver na di major suspect for di killing of Bamise wey be fashion designer.
Police say dem arrest di suspect on Monday afta dem find di bodi for Carter Bridge, Lagos Island.
Lagos police command carri di driver go court on Friday to ask for more time to hold am and complete dia investigation as di normal time to hold pesin under di constitution done elapse.
Magistrate O.A Salawu remand Andrew for police custody for 30 days. Na afta dat time dem go carri di suspect go back to court.
Tori be say Bamise enta BRT bus on February 26, 2022 wen she dey go from Lekki to Oshodi area of Lagos to go see her elder brother Pelumi.
She no reach her destination dat day wey make her family raise alarm.
Police later find her deadi body for one along Carter Bridge for Lagos Island..
Russia call for foreign volunteers to join fight
Russian President Vladimir Putin don call for foreign volunteers to dey allowed to fight against Ukrainian forces.
Im tok am for one Russian security council meeting, wia im say those wey wan volunteer to fight wit Russia-backed forces should be allowed to.
Russian Defence Minister Sergei Shoigu say e get 16,000 volunteers for di Middle East wey ready to fight alongside Russia-backed forces.
US officials say dis fit include Syrians wey dey skilled for urban combat.
Moscow na long-standing ally of Syria and Oga Putin don be key backer of Syrian President Bashar al-Assad for di kontri civil war.
"If you see say dis pipo dey wey want on dia own accord no be for money to come helep di pipo wey dey live for Donbas, then we need give dem wetin dem want and help dem get to di conflict zone," Oga Putin tell im defence minister.
'Positive' developments dey for Ukraine-Russia toks - Putin
"Positive" developments dey for di ongoing negotiations between Russian and Ukrainian officials, according to Russian President Vladimir Putin.
"Certain positive shifts don happun, as negotiators from our side brief me," Putin tell Belarusian leader Alexander Lukashenko - wey be key Russian ally - for one meeting for Moscow.
Na three rounds of negotiations between di two sides na im don happun 'negotiating teams on di Ukraine-Belarus border - and on Thursday di Ukrainian and Russian foreign ministers meet for toks for Turkey.
However, so far, no concrete results don comot from di toks.
Mr Putin also address di issue of sanctions against Russia, suggesting say dem fit get positive effect on di kontri.
"These na times of opportunity to move towards strengthening our economic and technological sovereignty," e tok.
Ukraine refugees don reach 2.5m
Di Ukraine refugee crisis dey grow day by day as a result of di conflict, and UN High Commissioner for Refugees Filippo Grandi do =n tok now say di number of refugees don reach 2.5 million.
Of dat number, like 116,000 na third-country nationals, AFP news agency quote am.
Anoda two million pipo don dey displaced inside Ukraine, e add.
Three oda wars wey Russia Putin get hand for, how dem start and how dem end
Mass burial for 13 victims wey die inside Appiatse mining truck explosion go happun today
Article Information - Author, Favour Nunoo
- Role, BBC Pidgin
Tears flow as Ghana dey hold mass burial for some 13 victims wey die after mining truck explosion hit Appiatse community for Western Region.
De victims of de explosion dey range from one 15 months old baby to one 80-year-old woman.
Govment fine de mining company, Maxam Company Limited $6million dollars after investigations show say dem breach regulations in de transport of explosives.
Preliminary reports wey police officials release be say de accident happen sake of crash between vehicle which dey carry mining explosives, motorcycle den a third vehicle close to electricity transformer cause de huge explosion.
Inside videos wey dey circulate for social media, you go see as one truck dey burn in de middle of de road wey people dey video de incident dey walk towards am.
While dem dey approach de burning truck, de tin just explode with a loud bang, tear down buildings, create big hole in de middle of de road wey e finally kill 13 people.
Di super-rich Russians wey dey face sanctions sake of Russia-Ukraine war and why
Fotos: Next Batch of Nigerians wey run from Ukraine War don land
122 Nigerians wey don run from di war from Ukraine don land Abuja di, Nigerian capital today.
So far Nigeria don evacuate one thousand and seventy six Nigerians including students from Ukraine.
Di kontri don gada money to helep about 5,000 Nigerians from di kontri wey Russia don dey attack since last month.
Dis na some fotos of dia return:
Fotos: Life for Kyiv as Russian attack still dey go on
Ukraine capital, Kyiv and di places wey surround am still dey under serious attacks by Russian forces.
May residents don run go west to find safer place to dey.
Odas wey wan hide from air raids dey for metro stations deep underground.
Dis na some fotos of how life be for Kyiv dis week:
Dem approach South Africa to mediate for di Ukraine war - Ramaphosa
President Cyril Ramaphosa say dem don approach South Africa to play mediation role for di conflict between Russia and Ukraine.
Mr Ramaphosa no say who approach dem, but say e speak with Russian President Vladimir Putin on Thursday and ask am to use mediated solution to solve di conflict.
"President Putin appreciate our balanced approach. We believe dis position enable both parties to subject di conflict to mediation and negotiation. Based on our relations with di Russian Federation and as a member of Brics, dme don approach South Africa to play a mediation role, "Mr Ramaphosa post on Twitter.
South Africa position for di conflict come under di spotlight last week afta dem abstain and dem no gree vote on a UN resolution wey condemn Russia invasion of Ukraine.
Mr Ramaphosa say di kontri abstain becos "di resolution no put as part of am di call for meaningful engagement", and accuse di UN Security Council
say dem dey unable to discharge dia responsibility to maintain peace and security.
E add say South Africa response to di war no be indication say dem no get regard for human rights.
Russia go lose 'most favoured nation' status
Di United States, di European Union and di Group of Seven kontries dey expected to revoke Russia "most favoured nation" trading status over dia invasion of Ukraine.
US President Joe Biden dey set to announce dis wan by 10:15am EST (15:15pm UK time), according to media reports.
"Most favoured nation" kontries generally no fit dey discriminated against or say make dem limit dia access to markets, under di World Trade Organization guidelines.
Dis move go open di way make dem impose tariffs on Russian goods on top di growing economic sanctions dem dey face.
Earlier on Friday, White House press secretary Jen Psaki condemn reports say Moscow fit seize di assets of businesses wey don stop operation for Russia.
Russia confam strike on Lutsk and Ivano-Frankivsk
Russia Defence Ministry don confam di strikes on Lutsk and Ivano-Frankivsk, local media dey report.
Dem quote Moscow defence officials wey dem say dia "high-precision, long-range attacks" don strike two military airfields for di cities for Ukraine west.
Dis wan mark new territory for di Russian attack wey bin focus on di Kyiv capital and cities for di east and south of Ukraine.
Di mayor of Ivano-Frankivsk don confam Russian shelling of im city for south-western Ukraine.
Inside Facebookmessage, e say: "Di enemy strike Frankivsk."
E ask pipo not to share fotos and videos of di explosions and seem to dey suggest say one missile strike alarm system bi no work.
And e warn residents of Krykhivtsi, Chukalivka, Opryshivtsi, Gorodok districs not to comot dia homes.
"Stay for house for your safety! Wen di danger pass - I go let you know," e add.
Nigeria seize hundreds of bags of donkey meat
Nigerian customs officials say dem don seize 1,390 bags of donkey meat for Kebbi, north west Nigeria near di border with Niger.
Joseph Attah reveal wetin di first investigate show say, na about 1,000 donkeys dem bin kill and pack dia meat inside bags.
E say na "illegal trade of wildlife" wey dey against di law for Nigeria.
Di place wia di truck wey bin dey carry am go, customs say dem neva know.
Howeva dem don arrest di driver of di truck and one oda suspect.
Nigeria don dey struggle to stop di killing of donkeys and selling of dia bodi parts sake of say dia numbers don dey drop steady.
Before-before, Nigerian officials say dem dey use donkey body parts plus di skin, sell give Asian kontris including China wia dem dey use am for traditional medicine and cosmetics.
Akwa Ibom State High Court sentence man to death by hanging for kidnapping
Article Information - Author, Karina Igonikon
- Role, BBC Pidgin, Lagos
One Akwa Ibom State High Court don sentence one 36 year old man, Monday Okon to death for kidnapping a three-year-old girl for Mbierebe Obio community in Ibesikpo Asutan LGA.
Justice Okon Okon convict Monday Okon for kidnapping and conspiracy and sentence am along with one Cecilia Ebong, wey assist am hold di pikin inside keke napep dem enter to AKTC Park, wia dem bin wan carry her go Aba, Abia State, to a standby buyer.
Monday Okon confess to police say im kidnap di pikin on 20 July 2018 during a graduation party for her school and keep her for im house in Ibesikpo Asutan for three days until im wife advise am to return di girl to wia e pick her from, but im no gree.
Luck run out on di convicts on 24 July 2018 while on dia way to AKTC Park, a good Samaritan see as dem cover di pikin with cloth inside di keke napep, come raise alarm for Aka Road-IBB roundabout in Uyo, wey lead to dia arrest.
Monday Okon confess say im bin wan deliver di pikin to one Charity Nwachukwu, wey im say im don sell one male pikin to her before for 2017 and get N50,000 for di transaction but Cecilia Ebong, however, claim to be di grandmother of di victim.
Delivering judgment, Justice Okon sentenced Monday Okon to death by hanging, while im sentence Cecilia Ebong to five years in prison.
Di judge say, “e dey unfortunate and depressing say pipo still dey into dis callous trade of human beings, particularly children, despite efforts of di goment to stop di ugly trend.
Di option of child buying and selling dey very bad and e no get any defence at all, and no punishment go dey too much to stop pipo from such tendency.”
Russia call meeting today to accuse America say dem dey use biological weapons
Di United Nations go siddon today to solve one kasala between America and Russia concerning di use of biological weapons.
Na Russia call for di meeting as dem accuse America say dem dey run one biological warfare programme for Ukraine.
Dem also accuse dem say dem dey use excuse of cleaning Soviet era research labs to take cover up wetin dem dey really do.
But Washington don say di mata no get head as e dey happun in di middle of Russian invasion of Ukraine even as Russia neva produce evidence for dia accusation.
Meanwhile, America don accuse Russia say na dem go fit already dey use chemical or biological weapons for dia invasion of Ukraine.
Dem add say di plan na to use di weapons come blame am on Ukrainian soldiers.
United Nations bin ban di making and use of biological weapons for war afta World War 1 under di Biological Weapons Convention.
Di latest headlines on Day 16 of di war
If you just dey follow, see wetin you need to know about day 16 of di Russian invasion:
- Ukraine president Volodymyr Zelensky don for inside one video addressrubbish Russian claim say dem dey develop chemical weapons or weapons of mass destruction for Ukraine. E also warn say Russia go get "di most severe sanctions response" if dem use such weapons against Ukraine
- Im comments echo wetin US tok earlier: say Russia claim of Ukraine hosting US-backed chemical weapons facilities na "false flag", wey dey intended to justify Russia possible use of such weapons
- Di UN go hold emergency meeting on Friday, for Russia request, to discuss dia claims
- Satellite images show say Russian sojas dey slowly advance, and don re-deploy into forests, as dem continue to push towards di capital Kyiv
- Putin forces according to reports dey circle several Ukrainian cities, with emergency officials warning say siege-like tactics mean say cities like Mariupol dey run out of food
- Toks between di foreign ministers of Russia and Ukraine for Turkey end with leaders saying dem no see hope for a lasting ceasefire in di near future
- Meta, di company wey get Facebook and Instagram, say dem go suspend rules wey ban violent speech in order to allow users in certain kontries to call for di deaths of Russian sojas
- More western companies don cut ties with Russia, including Western Union, JPMorgan Chase and Warner Music on Thursday
Una good morning!
Una welcome to our live coverage today of tori from around di world.
We go bring una tori from Nigeria, across Africa and di rest of di world.
Di world eye still dey Ukraine afta Russian invade dem.
E don pass two weeks now since di invasion.
Wetin to sabi about Russia President Vladimir Putin wey invade Ukraine