One man don tok about how e find out say Russian attack kill im wife and two pikin dem for Twitter wey show dia dead bodi.
Sarhiy Perebynis tell di New York Times say "I recognize dia luggage and dat na how I find out".
Tetiana Perebyinis and dia two pikin, Mykyta, 18, and Alisa, 9 die for di town of Irpin as dem bin dey try escape. For 2014, di family bin run comot eastern Ukraine to stay fo Kyiv on top di kasala dia between di Ukrainian army and Russian-backed separatists.
Serhiy bin dey take care of im mama wey dey sick before di war start.
And he tell di newspaper say e hear wiiinnn as e bin dey try enta Kyiv, dem force am go Russia to cross enta Poland.
E tell di Russian soldiers for di Poland borde say, "My whole family die for wetin you dey call special operation and we dey call war. Do as you like with me, I no get anytin to lose."
Serhiy write for Facebook for Russians sat wetin im face be like horror feem.
E write say "e dey hard to watch di wife wey you love dey lie down for black bag for ground".
E say also add, "I go go fight for dem to di end".