You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Victor Moses don retire from international football
Published
Read am in 1 mins
'I don hang my international boot final-final' na di announcement Nigeria midfielder Victor Moses make on Wednesday say im don retire from super eagles.
Na for Twitter, di Chelsea winger cari dis tori put wia im say 'thank you' to plenti pipo wey include; colleagues, NFF and Nigerians.
Moses na part of di team wey compete for di 2018 World Cup for Russia, na for di first round dem comot afta dem lose to Argentina for dia third match.