You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
Democracy Day: How Nigerians react to June 12 announcement
Published
Read am in 2 mins
Nigerians don already start to dey put mouth as President Muhammadu Buhari declare say Democracy Day na June 12 now.
For Twitter, di presido put statement say May 29 wey di kontri dey use to celebrate di national day no reach di kain level wey June 12 dey because, dat day for 1993, represent di day wey Nigeria do democracy true-true but military goment no gree.
Sharperly, Nigerians don already start to dey put mouth for dis change.