You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.
DR Congo Ebola deaths hit ova 5000 Ebola wit more dan 10,000 cases - wat next?
Authorities for Democratic Republic of Congo say di Bundibugyo species of di Ebola virus don dey linked to more dan 5,000 deaths, wey don raise concerns about di scale and continued spread of di outbreak.
For di report wey dem release on Friday, di Presidential Taskforce on Ebola say total of 10,351 confirmed cases dey recorded since di outbreak begin, including 5,026 deaths.
Health officials also report 77 new confirmed cases and 34 additional deaths.
"Di province of Ituri remain di epicentre of di outbreak, accounting for 71.0% of all confirmed cases reported and 36.4% of newly confirmed cases notified nationwide," di report say.
Of di kontri 178 health zones, 67 don report Ebola cases. Di outbreak don affect eight of di DRC 26 provinces and don record case fatality ratio of 48.6%.
Health authorities say 1,101 patients dey currently receive care for treatment and isolation facilities, while 2,788 pipo don recova from di disease.
Although response efforts kontinue, insecurity for eastern parts of di kontri wey dey affected by di outbreak don make tins worse for heaalth workers.
For some areas, response teams don face threats and attacks from pipo wey dey opposed to Ebola control measures.
Wat next for DR Congo
No current licensed vaccine specifically dey approved for di Bundibugyo species of Ebola virus.
Di Ervebo vaccine, previously used during outbreaks caused by di Zaire ebolavirus species, dey recently deployed to help protect frontline healthcare and response workers.
Di World Health Organization don repeatedly call for additional funding to support di response amid concerns about the potential for further spread.
Several kontris for Africa don strengthen surveillance and preparedness measures sake of di recent detection of Ebola case in Nigeria.
Uganda, Kenya, and France don also report cases linked to di wider outbreak.
Meanwhile, health experts, government officials and international partners dey meet for Kisangani, di DRC third-largest city, for di final day of a three-day Intra-Action Review.
Organised by di National Institute of Public Health, di meeting dey assess progress wey dem make during di response, identifying operational challenges and recommending adjustments to strengthen outbreak control efforts.
Now 167 days into di response, authorities report 78 new confirmed cases for di past twenty-four hours, alongside 32 deaths and 17 recoveries.
Most of di new infections dey recorded for Ituri and North Kivu.
Since di outbreak begin for May, di virus don spread to eight of di Democratic Republic of Congo 26 provinces and 67 health zones.
Sake of dis, di meeting dey try assess achievements, best practices, operational challenges and remaining bottlenecks for efforts to contain di virus.
Di meeting, wey go end on Saturday, dey expected to produce recommendations wey go strengthen surveillance, treatment and prevention measures, while helping adapt di response to realities on di ground.
Additional reporting by Emery Makumeno, from Kinshasa