Police to charge JIBWIS member go court ova alleged incitement of religious violence in viral video

Wia dis foto come from, ZAMFARA POLICE COMMAND/X
Zamfara State Police Command tok say dem don arrest one young man afta one video wey circulate for social media, wia dem allegedly see am dey sing one song wey dey call for di "killing of Christians."
Police tok say the video show di young man wearing di uniform of Jama’atu Izalatil Bidi’a Wa’ikamatus Sunnah (JIBWIS) organisation for Zamfara State, alongside some students from two Islamic schools for Maradun Local Govment Area.
According to di command, dem tok say JIBWIS first detain di 22 years old man bifor later hand am ova to police for investigation.
Police for Zamfara don now explain say dem don start investigation and dem go charge am to court.
Di state Commissioner of Police, Muhammad Bello, tok say di command go kontinu to protect di lives and property of members of di public regardless of religious differences.
Wetin dey inside di video wey cos kasala for Nigeria?
One video emerge for social media wey show one young man and im group of followers wey wear uniform wey pipo identify as dat of members of Jama'atu Izalatil Bid'ah Wa'iqamatus Sunnah (JIBWIS), one popular Islamic organisation across Nigeria.
For di video, dem hear am dey chant make dem give am “AK47, make e go Enugu on Sunday, while pipo dey rejoice, make e spray fire on dem.”
Dis don generate serious backlash against di Islamic organisation.
Di video bin spread for social media since Monday morning, wey some young men wearing volunteer uniforms wey pipo associate wit di Izala group under JIBWIS, don cause plenty reactions for Nigeria.
Di video, wey last for about one minute, na Lere Olayinka, Special Assistant to di FCT Minister on Public Communications, post for im X social media page while some oda pipo begin dey share am.
Howeva, some pipo bin try defend di young men, tok say pipo misunderstand dia statements.
Some of dos wey react call on authorities to invite di young men for investigation, while odas call for appropriate action against di organisation, alleging say di statements fit "show hatred" towards some pipo.
Wetin JIBWIS tok?
JIBWIS Nigeria na prominent Islamic organisation wey focus on religious awareness, education and unity among Muslims across di kontri, and dem also guide prayers for mosques.
Di organisation, wey pipo also sabi as Izala, don condemn di video, tok say say dem no agree wit di statements wey dem make inside am.
Di national leader of di organisation, Sheikh Abdullahi Bala Lau, call on di Department of State Services (DSS), Nigeria Police Force and oda security agencies make dem immediately carry out investigation to identify dos wey get hand for di matter and punish anybodi wey dem find guilty according to law.
For one statement wey one of di organisation publicity officers, Ibrahim Shehu Giwa, release on Monday, 26 October 2026, Sheikh Bala Lau tok say: "We dey call on DSS officials and di police to arrest di pesin wey make di video, wey dey wear relief corps uniforms and dey make statements make dem give am AK-47 rifles and go to Enugu on Sunday during exercise hours to carry out attack."
Di statement tok say Sheikh Bala Lau distance di organisation from di inciteful statements wey dem hear for di video and tok say threats and calls for violence against any community no be part of di organisation objectives and teachings.
E also tok say di fact say pesin wear di uniform of JIBWIS volunteer personnel or appear alongside im members no prove say di pesin dey speak or act wit di authorisation of di organisation.
Di leader express concern say some individuals fit dey try use di incident to damage di organisation reputation, and e call on security agencies make dem investigate di circumstances under which dem record di video, di pipo wey appear inside am, dia relationship wit di organisation and dia intentions.
"Even say e wear di uniform of our volunteers, pipo see e dey among us, e no mean say e we send am to tarnish di image of di organisation."
Amnesty International call for investigation into Izala march drill video
Amnesty International don call on Nigerian authorities to immediately and independently investigate di viral video wey show children and teenagers dey participate for marching drills under adult coordinators wey wear uniforms of JIBWIS for northern Nigeria.
For one statement, di human rights organisation describe di video as disturbing, saying di children dey chant slogans dey demand make dem give dem AK-47 rifles to attack pipo wey dem describe as 'infidels for Enugu and Jos on Sunday.'
Amnesty International say di slogans show how dem dey manipulate and brainwash children wit violence and hatred, add say activities like dis dey increase hatred and encourage violence.
Di organisation call on authorities to investigate di organisers and examine di source, location and content of di video. E also urge dem to review di slogans and lessons wey dem dey use during dis youth activities.
















