INEC final results show how Gov. Akeredolu sweep Ondo election
Ondo State Governorship Election latest updates from di sunshine state of Nigeria 10 October vote.
Live Coverage
Daniel Semeniworima and Helen Oyibo
Nigeria youth give police dia five demand afta dem dissolve SARS
Wia dis foto come from, OTHERS
As Inspector General of police, Mohammed Adamu dissolve SARS, one Nigerian youth don list five tins wey dem want police oga to do.
Dis inlude to release all arrested protesters of endsars, justice for all deceased victim of police brutality and compensation for dia families plus odas.
Governor Akeredolu celebrate im victory for Owo afta im win
Wetin we call dis foto, Govnor Akeredolu and im deputy celebrate dia election victory
Ondo state governor, Oluwarotimi Akeredolu celebrate im re-election win for Owo with im supporters wey dey hail am afta INEC declare am di winnner.
See photos of how di celebaration waka.
Wetin we call dis foto, Govnor Akeredolu and im deputy celebrate dia election victory
Wia dis foto come from, Govnor Akeredolu and im deputy celebrate dia election victory
Wetin we call dis foto, Govnor Akeredolu and im deputy celebrate dia election victory
Wetin we call dis foto, Govnor Akeredolu and im deputy celebrate dia election victory
President Buhari congratulate Akeredolu and tell am to serve di pipo beta
Wia dis foto come from, ROTIMI AKEREDOLU/FACEBOOK
Wetin we call dis foto, President Muhammadu Buhari congratulate Ondo state govnor Rotimi Akeredolu
Nigeria
President Muhammadu Buhari don congratulate di govnor of Ondo state state, Oluwarotimi
Akeredolu on im re-election and want make e use dis second term to serve di pipo of di state beta pass wetin im do
for im first term.
Oga
Buhari tok dis one inside statement wey one of im aide on Media and Publicity
Femi Adesina sign.
E advice di govnor to dey humble as e dey celebrate im victory.
Di
president also hail di Independent National Electoral Commission for di
credible election dem organize, security agencies wey maintain peace and
orderliness for di election and lastly, di pipo of Ondo state for di way dem conduct themselves for di election.
See INEC live results from INEC on who win Ondo Govnorship 2020 election
Breaking, Oluwarotimi Akeredolu don win Ondo election
Wia dis foto come from, Facebook
Governor Oluwarotimi Akeredolu na im be di winner of Ondo govnorship election.
Di Independent National Electoral Commission (INEC) declare Oluwarotimi Akeredolu of APC di winner afta e get 292830 vote to beat PDP Candidate,Eyitayo Jegede wey get 195791 votes.
APC win for Ese-Odo
Ese-Odo LGA
APC - 13383
PDP - 4680
ZLP- 4760
APC carri Ilaje LGA
Ilaje LGA
APC -26657
PDP- 11128
ZLP- 4405
APC win for Odigbo LGA
APC - 23571
PDP - 9485
ZLP - 6540
, Watch di result collation live
APC win Ondo West
Ondo West
APC - 15977
PDP - 10627
ZLP - 10159
APC win Okitipupa LGA
Okitipupa LGA
APC -19,266
PDP - 10,367
ZLP - 10,120
APC win Ose LGA results
Ose LGA
APC - 15122
PDP - 8421
ZLP - 1083
INEC final collation of Ondo Governorship Election Results
We dey here for INEC Collation centre for Alagbaka Akure wia INEC officials for di Ondo 2020 suppose resuming announcements of results by 9am.buut as e be some party agents don dey wait.
So far dem don announce results from 12 local goment results out of di 18 local goment wey dey di state.
Today di INEC returning officer for di state, Prof Aben Idowu Olayinka go preside on di announcements of di remaining 6 local goment and hopefully declare di winner of di Ondo 2020 govnorship election.
Breaking, INEC don march break
INEC don march break ontop di announcement of di final results from di local goment areas dem.
Before di break, dem bin don call 12 local goment areas out of di 18 wey dey di state.