US ask for peaceful elections for Ondo

Wia dis foto come from, Getty Images
Di United States don ask for all stakeholders in di upcoming Ondo elections make dem kontinue to dey work toward "free, fair, transparent and peaceful elections".
Di US embassy for Nigeria release dis one for statement 4 days before di 10 October govnorship elections wey 17 political parties go drag.
Read di full statement:
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Although some Nigerians go dey disappointed say di statement no contain strong word of warning against riggers and those behind election violence.
In di past di US don draw ear give pipo say anyone wey involve, support or mastermind bad behaviour inside election go chop visa ban to travel go America. And di ban go cover dia families join.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2















