You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.

Carry me go di main website

Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Breaking, Russia dey use cluster bombs for Ukraine - Nato

    Nato Secretary General Jens Stoltenberg say evidence dey say, Russia dey use cluster bombs for dia invasion.

    For news conference, e tell tori pipo say, "we don see di use of cluster bombs and we don see reports say dem dey use oda weapons wey dey against international law."

    E also tok say, di Western Military alliance no go set up no-flyzone ova Ukraine or send troops go dia but promise say dem go help Ukraine in oda ways and ask President Vladmir Putin make e stop di invasion now-now.

  2. How dangerous di attack be?

    As we don report, Ukraine say "several" pipo dey "killed and injured" wen Russia attack and seize control of di Zaporizhzhia nuclear power plant.

    Di UN's nuclear watchdog, di International Atomic Energy Agency, tok say none of di safety systems for di plant dey affected, and no release of radioactive material dey.

    But nuclear experts say di attack creat very risky situation.

    If a reactor - di device wey dey responsible for generating energy for nuclear power plant - and di building wey dey house am dey damaged, di reactor fit overheat and lead to core meltdown.

    Radiation from di plant fit den leak into di surrounding environment. If pipo dey exposed to dis radiation e fit cause severe immediate and long term health impacts, wey include cancer.

    Yet experts say - although di attack dey dangerous - important differences between di Chernobyl and Zaporizhzhia plants dey.

  3. Ukraine say pipo don die for fire wey happen for nuclear plant

    Plenti pipo don die and odas wunjure for di fire wey happen afta Russian army attack one nuclear power plant for Ukraine, di kontri foreign affairs ministry tok.

    Employees dey monitor di Zaporizhzhia plant to make sure say e dey operate safely and radiation level still dey normal, di ministry tok for statement dem publish on Facebook.

    But if anytin disturb di process to cool di nuclear fuel inside di power units e fit cause serious radioactive damage.

    “Thousands of pipo wey – including civilians wey no fit comot for di area near di plant sake of di war and attack wey dey happun – e go affect dem badly,” di statement tok.

    Sake of di reaction from di Ukrainian president, di ministry say nuclear disaster for Zaporizhzhia fit dey worse pass previous accidents for nuclear plants – including di one wey happun for Chernobyl and Fukushima.

    “Russia don consciously cause armed attack for di nuclear power site, action wey violate all international agreement inside di IAEA [International Atomic Energy Agency],” di statement add.

  4. 'Like students wey dey go camp, except dem dey carry assault rifles'

      • Author, Jeremy Bowen
      • Role, BBC Middle East editor

    Dis young men dem don volunteer to fight for Ukraine. Wen we meet dem yesterday, di boys still bin dey excited and patrioticfor di kind of young men dey dey when dem sign up for war.

    Some older men bin dey dia too, and dem look like dem fear pass di 18 and 9 year olds.

    Di teenagers resemble you dey go camping trip except dem bin dey carry assault rifles. Dem tok say dem bin only get three days training, but dem already sabi how to shoot and maintain dia guns.

    Dis morning we see dem dey man road blocks for di edge of di city. Apart from di live weapons dem also carry Molotov cocktails.

    Ukraine get professional army, and dem go fit use di volunteers for secondary roles.

    But if and wen Russia attack Kyiv, dis fit change sharp-sharp and volunteers but young and old fit find dia self for di middle of di kasala.

  5. President Buhari don return afta 3 days for Kenya

    Nigeria president Muhammadu Buhari don return to Abuja afta aim three days trip to Kenya.

    Na so Bashir Ahmad, Special Adviser to the president on Digital media tok for social media post.

    President Buhari return afta e participate for di 50th Anniversary of di UN Environmental Programme (UNEP) for Nairobi, Kenya.

    Tok-tok pesin for di president, Femi Adesina for earlier statement bin say from Kenya, President Buhari go go London for im routine medical check-up.

  6. NFF invite 25 man list of Super Eagles players wey go play Ghana

    Emmanuel Dennis and Ademola Lookman dey among di 25-man list di Nigeria football federation (NFF) invite to play di world cup qualifiers.

    Na captain Ahmed Musa go lead di squad wey de play Ghana for di world cup qualifiers play-off later dis month.

    Di two west African kontris dey meet wit di first leg wey dey happen for Ghana on 25 March while Nigeria go host di second leg on 29 March.

  7. E dey fair to ban sports pipo over politics?

  8. All you need know about Zaporizhzhia nuclear plant Russia attack

  9. Evacuees reunite with families in Nigeria

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    Over 450 Nigerians dem evacuate from di war in Ukraine don reunite with dia families back home.

    Nigeria goment bring di evacuees from Romania sake of di Russia invasion of Ukraine.

    BBC Pidgin capture some very emotional moments for di parents and children as dem reunite wit dia families and loved ones.

    Di day dey special for one woman wey come welcome her two daughters for di Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja

    Madam Salka say "I don get peace of mind, wit wetin dey happun for Ukraine, I no fit eat or sleep well, thank God say dem come back safely, God be praised!"

    Her two daughters tell BBC Pidgin say; "We no believe say we fit survive am, and we dey happy to comeback home, at least no tension here"

    E don pass one week since Russia invade Ukraine. Friday 4 March, 2022 make am nine days since di conflict begin.

    Dis na di first batch of evacuees we Nigeria goment bring from Romania.

    Nigeriaa goment promise to give dem 100 dollars each to transport di pipo wey no dey stay Abuja.

    National Emergency Management Agency(NEMA) na im co-ordinate di evacuation with di Foreign Affairs Ministry.

    Head of NEMA, Mustapha Habib say: “For di pipo wey dey stay outside Abuja, we go give dem 100 dollars each for dia transport”

    “We go support dem to make sure say dem dey okay” Habib tok.

    More Nigerian evacuees dey expected to land di kontri later today.

    Many of di returnees be students wey dey study abroad for Ukraine.

    Ukraine before now na home to over 76,000 foreign students, according to goment data from 2020.

    Nearly a quarter of di students come from Africa, with di largest numbers coming from Nigeria, Morocco and Egypt.

    Di students - studying medicine, engineering and business - be one important part of Ukraine economy.

  10. BBC: We go continue our efforts to dey available in Russia

    As we bin dey report today (see earlier posts) independent media don dey come under pressure inside Russia during di invasion.

    Now di BBC say dem dey try to keep dia news service accessible inside Russia, following reports say goment don block am.

    "Access to accurate, independent information be a fundamental human right wey no suppose dey denied to di people of Russia, millions of whom rely on BBC News every week," one spokesperson said.

    "We go continue our efforts to make BBC News dey available in Russia, and across di rest of di world."

    BBC's Russian language news website has had record audience numbers since Russia invade Ukraine.

    Visitors to di English language bbc.com site from Russia also dey up by over 250% last week.

    Russian TV don so far describe di war in a very different way to di rest of di world.

  11. Breaking, IAEA boss give update on Zaprizhhia nuclear plant attack

    IAEA Director General do press conference just a while ago on di situation in Ukraine.

    Rafael Mariano Grossi briefing start at about 10:30am afta Russia take control of Zaprizhhia nuclear power plant wey dey inside Ukraine.

    Grossi confam say di Zaprizhhia nuclear plant dey under Russia control.

    E however say na Ukrainians still dey inside di control room.

    Im call for negotiation afta im return from im mission to Iran.

    Di IAEA Director General indicate plans to consult Ukraine and Russia.

    Di radiation monitoring system for di plant and oda safety concerns dey normal at di moment, e add.

    IAEA - di International Atomic Energy Agency - na di world central intergovernmental forum for scientific and technical co-operation inside nuclear field.

    Di agency dey work for di safe, secure and peaceful uses of nuclear science and technology.

    E dey also contribute to international peace and security and di United Nations' Sustainable Development Goals.

  12. Asia stocks don drop after nuclear plant attack

    Share prices don go down for Asia after fire break out for Zaporizhzhia nuclear power plant for Ukraine, the largest in Europe.

    Na Tokyo and Hong Kong face di greatest fall and faced the steepest falls. Japan's benchmark Nikkei index dey 2.5% lower and di Hang Seng for Hong Kong dey down by 2.6%.

    Oil prices bin rise for Asia morning trade, and Brent crude bin dey above $112 a barrel.

    Di fire bin happen after Russia troops attack di plant.

    Ukraine emergency services bin tok say Russian troops block dem from getting to di scene but dem later manage to get to di plant to off di light.

    Di concerns of some investors dey calmed after officials tok say di plant safety don dey “secured”.

    Di International Atomic Energy Agency (IAEA) later tok say dem don tok to Ukraine leadership and dem say important equipment for di plant still dey work.

    Dis attack gather international condemnation.

    US President Joe Biden bin join Ukraine President Volodymyr Zelensky to urge Russia to stop di attack and allow firefighters to get access to di site.

    Russia invasion of Ukraine shock di global financial and energy markets.

    Di week, di cost of Brent crude - wey dey measure di global price of oil – bin jump above $100 a barrel.

    E bin rise to more than $119 to di highest since May 2012.

    Di cost of natural gas and coal don also jump on global markets.

    Wholesale energy prices wey dey go up don push di average cost of petrol and diesel for UK.

    Dem don also warn say household energy bill for UK fit reach £3,000 a year.

    Meanwhile, di Russian rouble has hit a record low against di US dollar as kontris for di world impose tough sanctions on di kontri.

  13. Johnson: 'Putin reckless actions fit directly threaten Europe'

    Britain prime minister Boris Johnson don tok say di "reckless actions of President Putin fit directly threaten di safety of all of Europe", according to one statement from a call between Johnson and Ukraine President Volodymyr Zelensky.

    Di call bin take place shortly after di news break about di fire for Zaporizhzhia nuclear power station for southeast Ukraine.

    One Downing Street tok tok pesin bin tok say di situation get grave concern. She add: “Both leaders agree say Russia gazz stop di attack on di power station and allow access for emergency service to di plant.”

    Johnson also tok say di UK go "do everything dem fit do to make sure say di situation no dey worse.”

    Im dey seek emergency UN Security Council meeting in some hours. Im tok say UK go raise di issue immediately wit Russia and close partners.

    "Both leaders agree say ceasing fire dey important,” di Downing Street tok tok pesin tok.

  14. Senegal fault Ukraine 'war invite' to dia citizens

    Senegal foreign ministry don summon Ukraine ambassador Yurii Pyvovarov after di kontri embassy call on Senegalese volunteers to enlist in di fight against Russia.

    Di Ukraine ambassador bin post for Facebook say make Senegalese volunteers join Ukraine war against Russia but di ministry tok say dis kind recruitment dey illegal.

    Senegal foreign ministry also tell Pyvovarov to delete di post.

    Dem no mention if dem go take further action.

    Senegal dey among 17 African kontris wey no vote at di UN General Assembly on resolution and withdrawal of Russian forces from Ukraine as both kontris dey fight war.

  15. Ukraine say Russian forces seize Zaporizhzhia nuclear plant

    Ukraine tok say Russian forces seize Zaporizhzhia nuclear plant

    Russian troops don seize di Zaporizhzhia nuclear power plant, di Ukrainian authorities tok.

    "Operational personnel dey monitoring di condition of power units," one local authority tok on social media, quoted by Reuters news agency.

    Station personnel dey continue to work and monitor di state of the power units, dem tok.

    Fire bin break out at di plant some hours ago - na di largest for Europe largest - after shelling attack by Russian forces.

  16. Nigerian evacuees set to board from Chopin Airport, Poland

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, BBC Pidgin, Abuja

    Anoda batch of Nigerian students wey escape di war from Ukraine and wey hide for Poland, don ready to board from di Chopin Airport for Poland.

    Na Air Peace flight A230 na im dey bring dem to Naija.

    The Poland Aviation Authority bin cancel dia flight on Thursday afta di crew exhaust dia duty hours.

    Di first batch of Nigerian students wey escape Ukraine war don land for Abuja dis morning.

  17. BBC dey restricted in Russia, state media report

    Russia communication authorities don limited access to BBC Russian Service inside di kotri.

    Na wetin goment-owned news agency RIA dey report.

    Two oda news outlets - Meduza and Radio Liberty - also don dey blocked, e tok.

  18. First set of Nigerian evacuees don land from Ukraine

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, BBC Pidgin, Abuja

    Di first batch of Nigerians wey dey stranded for Ukraine sake of di Russia invasion don land Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja Nigeria capital.

    Dis first batch of 415 pipo dey come from Romania and na Max Air flight VM602 fly dem into di kontri.

    Dem arrive di international airport around 7: 21 am on Friday morning.

    More details go follow.

    Chairman of Nigerians in Diaspora Commission don also confam di arrival.

    Abike Dabiri Erewa say di evacuees were brought back home by Max Air

    Nigeria is expected to evacuate 5000 citizens wey don japa from di Russia-Ukraine war.

    Many don cross into neighboring kontris of Romania, Poland and Hungary.

    Di returning of citizens dem bin earlier announce to start on Wednesday but e delay due to logistics challenges.

  19. Good morning - If you just dey join us - Dis na di latest updates, Daniel Semeniworima and Solomon Babatunde dey run live updates dis Friday morning.

    If una just dey join our live coverage of di Ukraine crisis, welcome.

    Dis na wetin happun ontop di Russia-Ukraine war overnight:

    • Fire bin break out at di nuclear power plant for Zaporizhzhia nuclear power plant - Na di largest for Europe - after shelling attack by Russian forces. Ukraine responders don manage to off di fire.
    • Ukraine State Emergency Services tok say no victims dey for di fire wey no affect di reactor sites but a nearby five-storey training site.
    • Russia attack cause immediate condemnation from Western leaders who call am “horrific” and “reckless” act wey threaten di safety of all Europe.
    • Ukraine President Zelensky bin call on oda nations some hours ago make dem take more action immediately against Putin "nuclear weapon".
    • Im also call on Europeans to “wake up” to di possibility of a global kasala like di 1986 Chernobyl nuclear meltdown. Zelensky tok say Russia na di first country in history wey try to bomb a nuclear power plant
    • For oda places, Russia dey strengthen dia campaign for di south of Ukraine, where dem dey close in on di key city of Mariupol after dem capture Kherson two days ago.
    • Over a million refugees don run komot from Ukraine. Both Russia and Ukaine don agree to establish “humanitarian corridors” to komot civilians.
  20. Breaking, Russian attack Europe largest nuclear plant for Ukraine - Zelensky

    Russian attack Europe largest nuclear plant for Ukraine, according to Ukraine president.

    Volodymyr Zelensky accuse Russians of deliberately shooting at di Zaporizhzhia plant six reactors using tanks equipped with thermal imaging.

    Zelensky raise fear about di "global catastrophe" wey bin happun for Chernobyl in 1986 and warn say consequences of a meltdown at Zaporizhzhia go be far worse.

    Di fire be like wetin dey sparked by artillery shells.

    Na around 4:00 GMT Friday morning tori land say firefighters don fit to access the Zaporizhzhya nuclear plant

    Dem quench di fire in di training building of Zaporizhzhya NPP in Energodar.

    “No victims dey for di fire" di State Emergency Service write on dia social media accounts.

    Di fire for Zaporizhzhia nuclear power plant burn for at least four hours before dem quench am at about 06:20 local time Friday