'We no get any wia to run and we no wan run'
Andrew Licholit, wey dey from Kharkiv, don join di city militia and e say e dey "help di regular arm and police to defend di borders of di city".
E bin join last week afta di invasion, afta e bin serve for 2015 and 2018 for di Donbas kasala.
E say dem dey control di situation but Russia dey commit military crimes.
"Dem dey commit air assaults for places for our city wey no get any military targets dia".
E say di Russians dey use pipo for di city to mark targets wey dem dey strike and di militia dey try find dis pipo and if possible catch dem.
"Right now, I know say we dey fight big and powerful army. But dis na our home, and we no get anywia to go. We no get wia to run, And honestly, we no wan run," na wetin Andrew tok.