You dey view text-only version of dis website wey dey use small data. Check di main version of di website wey get all images and videos.

Carry me go di main website

Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol

Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.

Live Coverage

  1. Catch up on di latest

    Day eight of di Russian invasion begin for Ukrainian capital Kyiv.

    Dis na wetin you suppose sabi:

    • Dem don hear massive explosions for Kyiv in di past hour, as video posted on social media show one enormous fireball light up di night sky.
    • Di International Criminal Court for The Hague don open one investigation into alleged war crimes by Russia
    • Di United Nations say di number of refugees wey dey run comot Ukraine don reach one million.
    • Ukraine President Zelensky release one video, dey call on citizens to do everything dem fit do to resist di Russian occupation.
    • US officials say one 40-mile (60km) Russian armoured convoy idon somehow "stuck" on im way to Kyiv.
    • Witnesses say Russia artillery bombardments don increase in di past 24 hours and fierce fighting still dey go on.
    • Russian troops don surround di strategic port cities of Mariupol and Kherson.
    • Kherson mayor say Russian troops don enter di city, but say for now e go remain under di Ukrainian flag.
    • For di northern city of Chernihiv, Ukrainian officials say two cruise missiles don hit one hospital.
    • For Kharkiv, Ukraine's second largest city, Russian shell continue to fall, report say e don kill and wunjure dozens of citizens.
  2. Good morning!

    Welcome to our daily live coverage of news from around di world.

    Join Daniel Semeniworima, Olaronke Alo dis Thursday morning for timely update of Ukraine-Russian war LIVE as e dey hot.

    BBC reporters from Nigeria, West Africa and across di world go bring una up -to-date wit wetin dey happun around you.

  3. Good night!

    Dis na wia we go end today BBC Pidgin Live Page.

    To catch up wit all di tori wey you fit don miss today, make you scroll down di page.

    We go return on Thursday 7am wit all di latest tori on Russia-Ukraine war as e dey happun plus oda ogbonge tori around di world..

    Na Jelilat Olawale, Faith Oshoko, Kareemot Salami, Onyinye Chime and Annette Arotiba bring una all di tori.

    Good night.

  4. Ukraine city of Mariupol dey 'near to calamity'

  5. Wetin don happun today?

    If you just dey join us, or want recap, here be di summary of some of di key points on day seven of di invasion of Ukraine.

    • Chelsea owner Roman Abramovich tok say im dey plan to sell di Premier League club.
    • Five kontries vote against condemning Russia invasion for di emergency UN General Assembly for New York.
    • Di UN General Assembly vote in favour of one resolution wey condemn Russia invasion and ask make Russia immediately pull all dia forces comot from Ukraine.
    • Di UNHCR dey beg for nearly $2bn (£1.5bn) for relief operation.
    • Athletes from Russia and Belarus go compete as neutrals for di 2022 Winter Paralympics for Beijing
    • Russia defence ministry don give im first numbers for soldiers wey don die during im invasion of Ukraine.
    • National Motorsport Authority don ban Russian drivers from competing for UK.

    Russian forces don increase attacks on key cities.

    For di south:

    • Russia say dem don take control of di PorKherson, although dia mayor say Ukrainian forces still dey hold on
    • Fears of mass casualties for di city of Mariupolnear di border wit Russia, wit di deputy mayor saying one district don dey "almost totally destroyed"

    For di Northeast:

    • Reports of one rocket attack for Ukraine second city of Kharkiv, on di regional police department and part of one university
    • Earlier, Russian paratroopers bin land for di city and begin fight for control, Ukraine military say

    for anoda developments:

    • More dan 2,000 civilians don die since Russia begin invasion, Ukrainian authorities don say
    • Peace tok go resume for Wednesday evening between Russia and Ukraine, according to Russia state news agency Tass
    • Di UK PM don urge opposition leader Kier Stamer to target Roman Abramovich owner of Chelsea Football Club - wit sanctions. Abramovich don deny say e dey close to Vladimir Putin
  6. Breaking, Chelsea: Roman Abramovich say e plan to sell club and go 'donate proceeds to war victims'

    Chelsea owner Roman Abramovich tok say im dey plan to sell di Premier League club.

    Di Russian billionaire for statement tok say e ''don take di decision to sell di club'' and promise say e go 'donate di proceeds to charitable foundation for di benefit of ''all victims of di war for Ukraine''

    E say ''I believe say dis na in di interest of di club, im fans, di employees, as well as di club's sponsors and partners.''

    Abramovich wey don deny say e get financial link to Russian President Vladimir Putin or di Kremlin but don come under increasing scrutiny in recent days, tok say di sale go dey fast-tracked.Link

  7. Who vote against condemning di invasion?

    Five kontries bin vote against condemning Russia invasion for di emergency UN General Assembly for New York. E no dey surprising, one be di Russia Federation self. But who be di odas?

    Equally e no dey surprising, Belarus also oppose di motion. One long-time Russia ally, di small kontri dey described by analysts as Moscow "client state". Some Russia troops enter Ukraine from Belarus territory.

    Anoda to oppose be Syria – wey im leader Bashar al-Assad rely on large-scale Russia military assistance to stay for power during Syria civil war.

    Eritrea for di Horn of Africa also oppose, as did North Korea for Asia.

    However China – wey earlier dis year join Russia say dem oppose further Nato expansion . Last week dem no dey there during one similar vote for di UN Security Council.

  8. UN condemn invasion and demand withdrawal

    Di UN General Assembly don vote in favour of one resolution wey condemn Russia invasion and don ask make Russia immediately pull all dia forces comot from Ukraine.

    141 out of di 193 members support di resolution for one rare emergency General Assembly session wey di UN Security Council arrange.

    Ahead of di vote, Ukraine UN ambassador Sergiy Kyslytsya say Russia bin "come to deny Ukraine of di very right to exist".

    Russian Ambassador Vassily Nebenzia say Russia wan stop separatist conflict for eastern Ukraine and accuse di West say e use "open and cynical threats" to get countries to vote for di resolution.

    Dis na di assembly first emergency meeting since 1997.

  9. Breaking, Ukrainian negotiators don depart for Belarus, Russia claim

    Russian officials say dem dey expect Ukrainian negotiators to arrive for di Polish-Belarusian border for di next round of peace toks on Thursday morning, wia dem expected to discuss ceasefire.

    Moscow's chief negotiator, Vladmir Medinsky, tell Russian media say di Ukranian delegation don leave capital city of Kyiv and dat Russian troops dey are provide security corridor for di delegates.

    Russia's foreign minister Sergei Lavrov tok say earlier on Wednesday say Moscow remain committed to di "demilitarisation" of Ukraine and add join say a list of specified weapons wey dem must never be deployed for Ukrainian territory suppose dey.

    But he tok say Vladimir Putin's regime recognise di Ukrainian pipo's right to chose dia own leader and dat Russia accept Volodymyr Zelensky as di legitimate president.

  10. In pictures: Shelter below Kyiv maternity hospital

    As Ukraine capital dey encircled by hostile Russian forces, authorities for di city dey tell civilians to stay inside preferably underground.

    One maternity hospital for di capital don convert a basement floor to medical ward wey allow pregnant women and newborn babies to dey cared for away from di crosshairs of Russian weaponry.

    Dis pictures, wey dey taken today, show as expectant parents and some of Kyiv youngest new residents dey tak shelter for di hospital basement.

  11. Nearly 900,000 pipo don run comot Ukraine since Russia launch attack

    Di United Nations Refugee Agency (UNHCR) say nearly nine hundred thousand pipo don comot Ukraine since Russia launch dia attack last week Thursday.

    Di UNHCR dey beg for nearly $2bn (£1.5bn) for relief operation.

    E add say di number of pipo wey go still run comot for Ukraine go pass di four million dem dey reason.

  12. Breaking, Nearly 500 Russian troops don die - Moscow

    Russia defence ministry don give im first numbers for soldiers wey don die during im invasion of Ukraine.

    E say 498 Russian soldiers don die and 1,597 wound so far, according to Russian media report.

    Di claim dey seriously less than Ukraine assessment of Russian deaths - Kyiv claim say e don kill 5,840 Russian troops.

    Russia don also claim say more dan 2,870 Ukraine service members don die and about 3,700 wounded. Kyiv neva give any figures.

    BBC no fit independently confam either di Russian or Ukrainian claims, but UK Ministry of Defence believe say Moscow forces suffer heavy loss.

    Earlier Ukraine emergency services say more dan 2,000 civilians and 10 emergency services workers don die so far.

  13. Winter Paralympics 2022: Russia and Belarus athletes dey classed as neutral afta Ukraine invasion

    Athletes from Russia and Belarus go dey allowed to compete as neutrals for di 2022 Winter Paralympics for Beijing afta di invasion of Ukraine.

    Di International Paralympic Committee (IPC) say di two countries "go compete under di Paralympic flag and no go dey included for di medal table".

    Di opening ceremony be Friday, wit competition to start on Saturday. IPC president Andrew Parsons say di measure be di "harshest possible punishment" under dia constitution.

    "Di IPC and wider Paralympic Movement dey worry sake of di serious violation of di Olympic peace by Russia and Belarus goments for di days bifo di Beijing 2022 Paralympic Winter Games," Parsons tok.

    "Di IPC Governing Board dey united for how dem condemn di actions and dem agree say dem no fit go unnoticed or unaddressed.

    "To decide di kind action wey di IPC suppose take,we go first work wit wetin dey our new constitution so we go remain politically neutral.

    "Dat kind neutrality be strong belief say sport hold di power to overcome our mistakes, and call from inside us di best of our humanity, especially in the darkest of moments." UK Secretary of State Nadine Dorries say she dey " disappointed" wit IPC decision.

    "I call on dem to urgently reconsider," she tok. "Dey must join di rest of di world to condemn dis barbaric invasion, make dem ban Russia and Belarus athletes make dem no compete.

    "We go consider di full range of options for di protest of dis decision, for consultation wit UK Sport and di British Paralympic Association. I go also meet wit my international colleagues dis week to tok about how we fit answer together."

  14. Heartbreaking farewells as fighting close for Dnipro

    Dis na desperate scenes for di train station for Dnipro, as Russia war on Ukraine dey get uncomfortably close and families don begin dey run from west, from di fighting.

    E no get any time or destination on di departures board, just big crowds of people for di station steps, for di halls and platforms.

    As train dey enta di station, crowd go begin push forward to squeeze on board. Nobody dey even ask wia e dey go.

    Most people dey carry only small bags: plastic bag - but some carry dia pets inside crates becos dem dey fear say dem fit no come back.

    For di crowd, men dey shout orders for dem to make way for women and children to pass; na so so screaming and tears and last hugs.

    Fathers kiss di train windows and press dia hands for di glass.

    Den dem go pull away in tears, so dia children no go see.

    One man tell me say im dey stay to fight. We go win, im tok, like say im dey try convince imsef – not telling me.

    But dis goodbyes dey heart breaking.

  15. Russian drivers in Formula 1 dey banned from competing for UK

    National Motorsport Authority don ban Russian drivers from competing for UK.

    Motorsport UK gp refuse to recognise licences of competitors from Russian federation until further notice.

    Dis one mean say Nikita Mazepin no go fit race for July British Grand Prix even if e continue to be part of Haas team.

    Mazepin papa, Dmitry na im dey provide financial backing to Haas and e dey close to Russian President Vladimir Putin.

    Haas dey expected to cut ties wit dia Russian driver.

    Motorsport UK decision dey come afta FIA, di international governing body wey dey decide to allow Russians compete for events ban teams from di kontri.

  16. Roman Abramovich wan sell Chelsea?

    One Swiss billionaire Hansjorg Wyss don tell tori pipo, Blick say Roman Abramovich don offer am di chance to buy Chelsea football club.

    E say di Russian billionaire “wan offload Chelsea sharp-sharp” afta dem threaten am with sanctions for Parliament.

    Wyss bin also tok say, “I and three oda pipo bin get di offer to buy Chelsea. Abramovich dey try sell all im villas for England and also wan comot Chelsea from in hand sharp-sharp.”

    Abramovich bin hand ova “stewardship and care” of di club give dia foundation trustees afta Russian invasion of Ukraine last month.

    Howeva neither Chelsea or Abramovich don ansa di clams by di 86 year old Wyss. Even as di club don tok before say e no dey for sale.

    Since Abramovich buy di club for 2003, Chelsea don win all di trophies wey dem fit winm including two Champions League, Five Premier League and FA Cup, twpo Europa League and three League cups and di 2021 Uefa Super Cup and club World Cup.

  17. Breaking, Mass casualties feared for Mariupol - official

    Officials for di south-eastern city of Mariupol, near di border wit Russia don express fear say many pipo fit don die for di area sake of continuous shelling on di city.

    Deputy Mayor Sergiy Orlov say one riverside district wey normally be home to 130,000 pipo including im papa don dey "nearly totally destroyed".

    “We no fit count di number of victims there, but we believe say at least hundreds of pipo don die. We no fit enta go carry dia deadi bodies," e tell BBC for phone.

    "Di Russian army dey use all dia weapons work for - artillery, multiple rocket launch systems, airplanes, tactical rockets. Dem dey try destroy di city,” Orlov tok.

    E say Russian forces dey for several kilometres away on all sides.

    "Ukrainian army dey very brave and dem go continue to defend di city but di style of di Russian army be like pirates. Dem no dey fight with dia army, dem go just destroy entire districts," Orlov tok.

  18. Breaking, Ukraine War: Buhari don pproves $8.5m to evacuate stranded Nigerians

    Nigeria President Muhammadu Buhari don approve $8.5 million to evacuate at least 5,000 Nigerians wey dey stranded sake of di war between Russia and Ukraine.

    Di Ministry of Foreign Affairs and di Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development do joint memo wey di FEC approve on di moni wey dem go use evacuate Nigerians wey now dey for Romania, Hungary, Slovakia, and Poland.

  19. EU condemn Museveni tweet ova Ukraine Kasala

    European Union (EU) diplomats don condemn di tweet of di powerful son of Uganda President Yoweri Museveni, Lt Gen Muhoozi Kainerugaba, say im support for di Russian invasion of Ukraine.

    On Tuesday, Gen Kainerugaba tweet say "di majority of mankind (wey no be white) dey support Russia stand for Ukraine. Putin dey absolutely right!"

    Di deputy oga of di European Union delegation for South Sudan, Dionyz Hochel, say di comment dey unacceptable and Uganda fit face ogbonge consequences if dem officially suppot Russia invasion.

    E tell tori pipo for Juba say, "We condemn dis statement. We dey expect sensitivity and say kontris for dis region go dey collabo with EU and oda like minded kontris to condemn di Russian attack for Ukraine".

    Di United Nations General Assembly go vote on Wednesday on resolution to condemn Russia invasion on Ukraine.

  20. Why Russia dey invade Ukraine?

    As di Russian invasion of Ukraine dey enta one week, wit casualties on both sides, many pipo still dey wonder, wetin cause di kasala.

    No worry. We get di ansa for here.

    And as dat one dey pipo mind, Europe and di rest of di world dey ask again, wen di fighting go end.