Ukraine say Russian troops strike southern city of Kherson
Ukraine officials say Russian troops don begin launch strike on Kherson.
Kherson na one city wey dey for di south of di Eastern European kontri.
BBC reporter wey dey on ground say dem hear powerful explosions near di Kherson airport dis morning.
Earlier missile don hit di centre of Ukraine second-biggest city Kharkiv.
Ukraine president don describe di bombardment of Kharkiv, wey don kill dozens of civilians, as a war crime.
Nine pipo, including three children, na im dem kill on Monday afta suspected Russian cluster bombs bin target residential buildings inside Ukraine second city.
Inside comments wey e make before di latest strike in central Kharkiv, Volodymyr Zelensky say dem get eyewitness accounts of civilians being deliberately targeted.
"Russian forces brutally fire on Kharkiv from jet artillery."
Di International Criminal Court's chief prosecutor, Karim Khan, don opened one investigation into Russia's invasion.
Khan say he believe say e get "reasonable basis" to believe war crimes or crimes against humanity don dey committed in Ukraine.