Now make we quickly recap di Ukraine-Russia war so far.
Ukrainian authorities don announce say dia delegation don arrive Ukraine-Belarus border to start peace tok-tok wit di Russian delegation.
Di main issue on dia agenda, dem say, na a ceasefire and withdrawal of troops from di Ukrainian territory.
Earlier, report say dem bin dey postpone di peace tok-tok due to logistical and safety issues.
By air, land, and sea, Russia don launch one deadly attack on
Ukraine.
Intense fight-fight continue all through di weekend, as Russian
forces dey target cities for inside Ukraine.
But dem fail to hold di city Kharkiv, for di northeast of di
kontri, wey be Ukraine second largest.
However, di assault from Russia dey continue from all from
almost all directions.
And tori be say Kremlin forces dey make better progress from di
south, besieging di port cities of Kherson and Berdyansk, on two parts of di
Black Sea.
Ukrainian President Volodymyr Zelensky announce plans to meet
one Russian delegation for di Ukrainian-Belarusian border afta tok-tok wit
Belarus leader Alexander Lukashenko.
Dem neva offer timeline and di situation still neva clear, as
Belarus dey support Putin invasion.
Belarus say dem don prepare venue to host tok-tok between
Ukrainian and Russian delegations.
Dis dey come as Moscow invasion of im western neighbour enta di
fifth day.
Ukraine don agree to send diplomats to one location near di
Ukrainian-Belorussian border.
Ukraine na one European democracy of 44 million pipo.
Russian forces and dia forces dey for di outskirts of di
capital, Kyiv.
For months, President Vladimir Putin bin deny say e go enter im
neighbour.
But on Thursday 24 February, Putin tear up one peace deal, and
send forces across borders for Ukraine north, east and south.