Netflix go begin test-charge customers wey share dia password wit pipo outside dia household

Wia dis foto come from, Getty Images
Netflix wan make pipo stop to dey share dia passwords wit friends and dem dey carry out one new effort wey fit make am stop.
Di streaming service say e go soon launch one test wey e wan use crack down on password sharing outside di user household.
“We don always make am easy for pipo wey live togeda to share dia Netflix account, wit features like separate profile and multiple streams for our standard and Premim plans”, Netflix tok for one blog ppost on Wednesday.
“While dis don become popular, e don also create some confusion about wen and how pesin fit share Netflix. Sake of dis pipo dey share accounts between households and e dey affect our ability to invest in great new TV and feem for our members.”
Dis test go start in di new week for three American kontris: Chile, Costa Rica and Peru.
Through dis test, Netflix go start to let Standard and Premium plan customers add accounts for up to two people wey no dey live wit dem, and dem go pay extra monthly charges.
Dis extra member go get dia own profile plus personal recommendations, login and password.

















