Welcome!
God morning.
Welcome to today live-text report of stories from around di world.
Remember say: "Pesin wey use elephant set trap, na only im know wetin e wan catch."
Dat na our proverb for taday to use welcome you.
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
God morning.
Welcome to today live-text report of stories from around di world.
Remember say: "Pesin wey use elephant set trap, na only im know wetin e wan catch."
Dat na our proverb for taday to use welcome you.
Na here we go end today BBC Pidgin Live page.
So far, we don report say US go send $1bn in weapons to Ukraine.
National grid wey collapse for Nigeria don recover according to di kontri's minister of power, Abubakar Aliyu.
We also tell you say International Court of Justice don order Russia to stop di katakata for Ukraine.
Na Jelilat, faith and Tamara bring una all di tori for today.

Wia dis foto come from, bbc
Mariupol deputy mayor tell BBC say Russian forces bomb one theatre wey hundreds of civillians bin dey hide from di kasala.
Serhiy Orlov say na between 1,000 and 2,000 pipo bin dey di building and e neva dey clear l how many die for di attack.
Di BBC no fit verify dis information by weself.
Mariupol dey surrounded by Russian forces and about 300,000 pipo dey trapped inside without water, electricity or gas. Food and medical supplies don dey less more more, and Russia no wan allow humanitarian aid enta.
Di city dey under Russian shelling since di war start and e don scata neighvbourhoods finish. Last week, dem attack hospital kill five pipo.
Orlov also say Russia attack convoy of civilians wey bin dey comot di city and injure five pipo wey include one pikin.
Police for Imo State don confam say two Prison wardens don die after some hoodlums attack dem for Okigwe, Imo State, South East Nigeria.
Police tok tok pesin CSP Michael Abatam tell BBC Pidgin say di hoodlums ambush di unsuspecting Wardens with dynamite attack for di motor wey dem bin dey drive and e kill two of dem on di spot while one dey injured.
Abatam say security agencies don take over di area with patrols and investigation don begin to fish out di hoodlums wey dey involved.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di White House don confam e go commit $1bn (£764m) to di direct transfer of weapons to Ukrainian forces.
Biden say di continued support dey about "making sure say Ukraine go never be a victory for Putin".
E note US security assistance to Ukraine over di past year - $650m in weapons and $350m in additional aid - amounts to "more dan we don ever provid before".
Di newly-announced support includes drones, 800 anti-aircraft systems and 9,000 anti-armour systems, as well as machine guns, shotguns, grenade launchers and 20 million rounds of ammunition.
Allies too don step up dia support to unprecedented levels, Biden add join.
"We're go continue to stay di course and do everything we fit to push for an end to dis tragic, unnecessary war," he tok.
Di International Court of Justice(ICJ) Judges don order Russia to suspend military operations for Ukraine.
Dem say Russia must immediately stop military operations for Ukraine and make sure say military units or pipo wey dem dey support or control no take any steps again for di military operation.
Both parties must stop from any actions wey fit increase di katakata pr make am hard to settle.
Di Judges no gree order Russia to report back on progress, but International legal obligations to make Russia to do as dem tok.
Ukraine President Volodymr Zelensky claim say na " complete victory" and tok say if Russia ignore di order e go dey on e own.

Wia dis foto come from, Getty Images
Minister of Power, Abubakar Aliyu, say dem don restore di the national grid wey collapse few days ago.
E tok on Wednesday during briefing afta di Federal Executive Council (FEC) meeting say plenti resolutions don come out afta plenti emergency meetings wey di Ministry of Power hold wit all stakeholders, and dem extensively discuss di issues and resolved all di problems.
Di minister emphasise say Nigeria dey generates up to 8,000 Mega Watts of power
According to Aliyu, di shortage of gas and maintenance of generators,plus di current fuel situation combine to make di problem worse for di national grid.
E assure say di Federal Executive Council don approve Five billion Naira to open up and expand Lagos/Ogun, to reinforce power supply to dat region.
Dem don throw Russian Federation out of di Council of Europe.
Di council na Europe's oldest political body and aims to uphold human rights, democracy and di rule of law across di continent.
One statement from di council's committee of ministers say after an "extraordinary" meeting, Russia's membership don dey suspended.
Di procedure to end Russia's membership first start on 25 February - one day afta President Putin's forces enta Ukraine, and almost exactly 26 years since Russia first join.

Wia dis foto come from, Getty Images
Ukraine now dey connect to di main European power grid, to fit fight di power outages wey Russia attacks dey cause.
Na Ukraine President Volodymyr tok dis one for one post on Twitter say power don dey flow back an forth between Ukraine and di EU.
Zelensky thank di senior EU officials wey make am happun.
EU Commission President Ursula Von der Leyen say di move go "keep light in and houses dem warm for dis dark times".
EU Commissioner for Energy Kadri Simson say, at least, "for dis area, Ukraien now dey part of Europe".

Wia dis foto come from, Getty Images
If una just dey join us, hia na some of di tins wey don happun today wey be di third week of Russian invasion of Ukraine.

Wia dis foto come from, Getty Images
E go soon be one full month since dem arrest ogbonge Women's Basketball Player Brittney Griner for Russia on top say she bin get vape cartridges with hashish oil.
Brittney Griner don dey play for di WNBA for almost nine years and her fans call am say she be di greatest female basketballer of all times.
Tori be say she go Russia for di WNBA off season to play for di league dia for February, shortly before US teams bin start to dey pull dia players from di Russian Federation.
More than half of di WNBA players dey go play for Russia every off season as dem dey pay dem five times wetin dey collect for America.
Di numbers show say NBA players dey gbab pass 200 percent of di highest money players dey make for di WNBA.
So far, US congressman John Garamendi say, dem neva allow any pesin from di American Embassy for Ukraine to get consular access to am.

Wia dis foto come from, Anambra Police command
Police for Anambra state say dem don arrest gang members of one cult group wey allegedly attack and kill pipo one burial ceremony for Ebenebe area of di state.
Commissioner of police for di state Echeng Echeng tok dis wen im dey real out some of di activities of im command on Wednesday.
E say di gang also allegedly dey responsible for attack and killing of two police men for December 2021, say dem collect two Ak47 riffles from di officers during di attack.
CP Echeng say im officers ambush di gang wen dem go attack one vigilante group and kill di gang leader Uchenna Nwobu alias Anali

Wia dis foto come from, Anambra Police command

Wia dis foto come from, Getty Images
Motorbike gunmen don kill six police officers wey dey guarde one tomato-processing factory for Kebbi, north-western Nigerian.
Dem also kill one civilian for di attack.
One police toktok pesin tell BBC say di attackers bin wan kidnap foreign nationals wey dey work for di factory - but dem evacuate dem safely.
Di region dey grapple wit armed motorbike gangs, known locally as bandits, wey dey frequently steal animals, kidnap for ransom and kill those who confront them
Dem be sophisticated networks of criminals wey dey operate across large swathes of territory.
E don lead communities to form local vigilante groups to try and defend villages and towns from attack.

Wia dis foto come from, Getty Images
Manchester United say dem dey review CCTV footage to identify fans wey throw objects inside pitch afta dia 1-0 loss to Atletico Madrid.
Some body throw some objects on Atletico boss Diego Simone including bottles afta di final whistle for OId Trafford.
Uefa dey wait di reports from match observers before deciding whether to charge di club.
To throw objects inside field of play dey against ground regulations and subject to three year ban.
Ralf Rangnick side comot from di Champions League afta a 2-1 defeat on aggregate to di Spanish club.
Di result spoil United hope of ending five-year trophy drought, meaning dem dey on dia longest run without trophy since di period between FA Cup wins for 1977 and 1983.

One State High Court for Port Harcourt don sentence three out of five suspects to death by hanging for di kidnap and murder of former Director of Finance and Supply Rivers State Ministry of Health, Charles Nwogu and Chief Promise Wali.
Dis incident happen on di 11th and 21st June, 2012 for Rumuokwuta and Woji Community all in Obio/Akpor local goment area and di trial don last 10 years before dis judgement day.
Di three convicts : Andy Clement Ogbu, Goddrey Handson and Chima Morrison Nwokoma bin dey face nine count charge of conspiracy, kidnapping and murder.
Di court also discharge and acquit two odas Obinna Okereofo and Ogechi Innocent- Ihunwo of di same charges of conspiracy and murder.
Presiding Judge, Justice Adolphus Enebeli as e deliver di judgement say di prosecution really prove di case of conspiracy, kidnapping and murder charges wey dem bring against di three convicts.
Justice Enebeli come sentence dem in line with section 401and 402 of di State administration justice law as di convicts contravene section1 sub 1 of di State Anti-kidnapping law as well as section 319 of criminal code and di various laws stipulate death by hanging upon conviction.
Di convicts get right to appeal di judgement and sentencing of death by hanging up to di Supreme Court and Goment authorities wey be either di State Governor or di President need to sign dia death warrants before dem fit execute di death sentence.
Since di return to Civilian rule for 1999, no State Governor for Rivers State don sign death warrant for di execution of death sentences wey Courts don give and such convicts still dey serve prison terms for Correctional Centres.

Wia dis foto come from, EPA
Nazanin Zaghari-Ratcliffe, di British-Iranian woman wey bin dey detained for Iran nearly six years ago, dey on her way back to di UK, her MP don tok.
Mrs Zaghari-Ratcliffe dey for airport for Tehran, Tulip Siddiq tell BBC News.
She dey di holding room wit fellow British-Iranian detainee Anoosheh Ashoori, she tok.
Mrs Zaghari-Ratcliffe chop arrest for 2016 - accused of plotting to overthrow Iran's government, which she denied.
Mr Ashoori chop arrest for 2017 on top accuse of spying, wey e deny.
Meanwhile, Mrs Zaghari-Ratcliffe don dey under house arrest since and dem give her her UK passport back dis week.
Di Prime ministers of Poland, Czech and Slovenia don go back to Poland afta dia visit to Kyiv, one Polish goment tok-tok pesin reveal.
“Di Polish, Slovenia and Czech delegations safely return,” Piotr Muller write on Twitter.
Di leaders, wey di head of Poland governing Law and Justice party, Jaroslaw Kaczynski join for di trip, travel go Kyiv by train in show of solidarity wit Ukraine.
Na dem be di first set of leaders to visit di Ukrainian capital since war start.

Wia dis foto come from, EPA
Earlier Liz Truss say di first refugees under di UK Homes for Ukraine scheme go arrive next week, but we don get update on how many visas dem don grant under di oda scheme.
Di scheme allow family members to join dia reletives wey base for UK.
Immigration minister Kevin Foster tell Commons home affairs committee say 20,000 Ukrainians don apply to come UK.
E say so far, dem don grant 5,500 visas.

Wia dis foto come from, Charles Soludo
Di outgoing governor of Anambra state Willie Obiano don tell di State House of Assembly to support di governor-elect, Prof Charles Soludo as dem support am.
Obiano make di appeal for valedictory session for di State Assembly dem organise to honour am.
Di administration of di current govnor go expire tomorrow wen e go officially handover to di govnor- on Thursday.
Soludo go dey sworn in as di 6th executive governor of di state.
“I appreciate di House for honouring me and for your kind words. E always hard to say goodbyes but I go remember una.
“I wan beg una to give di incoming govnor di same legislative support and assistance una give me” e tok.