Abba Kyari first Wife faint for Abuja court
Di first wife of di suspended Deputy Commissioner of Police, DCP, Abba Kyari, Ramatu on Monday, faint for Federal High Court, Abuja.
She fall for ground as armed NDLEA officers dey try carri Kyari comot from di courtroom afta di trial judge, Emeka Nwite adjourn ruling on Kyari and four odas bail application to 28th of March, 2022.
Kyari lawyer bin file application to release am on bail pending di determination of di case against am.
Kyari wife bin wear black cloth and bin hold her husband hand as dem stand close to di elevator wey dey go di fifth floor of di Federal high court - suddenly she fall for ground.
She later regian consciousness afta some minutes.

Wia dis foto come from, Other














