Ukraine's president, Zelensky say Russian shelling dey affect evacuation for Mariupol
Latest news updates on Ukraine-Russia war and di big tori dem from around di world.
Live Coverage
Make you scroll down to read today stories
Na here we go match break for today coverage of wetin dey happun as e concern Russia invasion of Ukraine and all the oda big tori from around di world.
No forget say you fit scroll down to read more on di tori wey you fit don miss today.
Make you join us tomorrow for more coverage on di tori wey dey make headlines around di world.
One group of Nigerian students wey goment evacuate from north-east Ukrainian city of Sumy don arrive Hungary. Di students bin hook for frontline before dia evacuation begin on
Tuesday.
Di students bin dey on di road
for almost two days.
Reports say dem bin first move dem from Sumy to di Ukrainian central city of Poltava from where dem joine train enter Hungary.
On Thursday, di students meet with representative of di Nigerian embassy for Gyor, for northwest Hungary before dem put dem for anoda train.
One of the
students, Samuel Otunla tell BBC say dem bin don travell for about 30 hours. Im express relief after e leave Sumy and add say Nigerian government dey do very good job so far.
Before di evacuation, several Sumy students
bin no fit leave di city due to di blockade of the access routes.
Pfizer dey set to supply Covid pills to Africa
In other news, Pharmaceutical company Pfizer dey set to supply Africa top health body with dia coronavirus drug.
Di drug - Paxlovid - dey intended for use soon after symptoms develop for pipo wey dey at high risk of severe disease.
Paperwork for di deal between di Africa Centres for Disease Control and Pfizer now dey in di hands of di African Union legal office - after which dem go make formal announcement, na so Africa CDC director John Nkengasong tok.
UK saction Abramovich - Wetin e mean for Chelsea FC?
Wia dis foto come from, Getty Images
Roman Abramovich attempt to sell Chelsea don dey on hold after di oligarch chop sanction from UK government as part of dia response to Russia invasion of Ukraine.
Di Russian put di European champions up for sell after UK parliament bin raise threat of sanctions.
Freezing of Abramovich's assets,wey include Chelsea, mean say di club no go fit sell match tickets.
Di intention of di move na to stop Abramovich from making money from Chelsea.
Season-ticket holders fit still attend games wey dem bin don already buy tickets but di club no go fit sell any more tickets from today.
Chelsea go also dey unable to buy or sell players, or offer new contracts, while di sanctions dey for Abramovich head.
Dem don also close di London club merchandise shop.
First round of toks between di foreign ministers of Russia and Ukraine don fail to yield progress on ceasefire, na so Ukraine tok.
Speaking after di meeting wey hold for Turkey, Dmytro Kuleba say di demands im Russian counterpart Sergei Lavrov make amount to surrender.
Mr Lavrov meanwhile say im kontri military operation dey go according to plan.
Di toks dey come after Russia bomb children's hospital, which Ukraine say be "war crime".
Officials say three pipo including one pikin die for di attack wey happun for south-eastern city of Mariupol.
Russia launch a full-scale invasion of Ukraine two weeks ago and more than 2.3 million pipo don run comot from di country.
Bombs dey fall for Mariupol - reports
Wia dis foto come from, Reuters
Bombs reportedly dey fall ontop homes for di Black Sea port city of Mariupol again, according to one Telegram post from di city council.
A humanitarian convoy wey dey try reach di south-eastern city don has turn back sake of di fighting, according to one social media post from Ukraine's deputy prime minister, Reuters bin report.
One Ukrainian presidential advisor tok say on social media dat Russia dey deliberately block di evacuation of civilians from di city sake of dem fail to seize di strategically-important port, Reuters tok.
Di south-eastern city don be di site of di fighting. Yesterday, dem bomb one maternity hospital, killing three pipo, wey include one child, Ukrainian officials tok.
Wetin Abramovich sanction mean for Chelsea
Di latest developments from Ukraine
Wia dis foto come from, Reuters
Una well done, those wey just dey join us, dis na di summary of di latest happening from Ukraine:
Di foreign ministers of Russia and Ukraine dey hold peace tok for Antalya, Turkey
US Vice -president Kamala Harris dey Poland one day afta her administration reject Poland proposal to transfer jet fleet to di US, instead of to give am directly to Ukraine
Di UK yarn say Moscow dey deploy conscript troops to Ukraine even though Russian President Vladimir Putin bin give assurance this week say e no go happun
Report say four pipo don die and out of dis number, no na pikin. Dem die afta Russian forces for night bomb one residential building near di city of Kharkiv according to Ukraine's State Emergency Services
White House officials don warn say Russia don dey grow desperate and fit use chemical weapons to attack civilians in coming days
US officials estimate say between 5,000 to 6,000 Russian troops don die so far for Ukraine
Ukraine's President Zelensky yarn give say Russia Bombing of hospital for di besieged city of Mariupol wey destroy maternity and pikin wards- na war crime
Plenti private companies don pledge to end business for Russia, as di kontri economic isolation kontinu.
Breaking, Russian and Ukrainian foreign ministers dey meet
Wia dis foto come from, Getty Images
Di Russian and Ukrainian foreign ministers dey meet for di first time since Russia's invasion of Ukraine start, Reuters news agency dey report.
Russian foreign minister Sergei Lavrov and im Ukrainian counterpart, Dmytro Kuleba, dey for Antalya, Turkey.
Breaking, UK sama Chelsea owner Abramovich sanction
Di UK goment don sama Chelsea football club's owner Roman Abramovich sanction.
Di Russian billionaire na one of seven Russian oligarchs whose assets don dey frozen.
For one UK Treasury documentwey dem post online, Abramovich dey described as "pro-Kremlin oligarch" wey get close associations to Russian President Vladimir Putin.
Abramovich don previously deny say im get close financial ties wit Putin or the Kremlin.
Ghana gold businessman wan buy Chelsea Football Club for $3.1billion dollars, Ghana gold business man declare bold plan to buy Chelsea Football Club for $3.1billion dollars
Article Information
Author, Favour Nunoo
Role, BBC Pidgin, Accra
Ghanaian gold businessman and politician dey trend after he declare interest to buy Chelsea Football Club.
Bernard Antwi Boasiako popular known as Chairman Wontumi say he put in $3.1 Billion dollars bid to own take over affairs for Stamford Bridge.
De popular gold businessman say he go buy Lionel Messi and Christiano Ronaldo make dem play for de Blues.
Social media dey blow over de idea say as African, he make bold move to own English club.
Current owner Roman Abramovich put de club up for sale after Russia-Ukraine war start.
Wia dis foto come from, Chairman Wontumi/Instagram
Wetin we call dis foto, De gold businessman and politician set social media on fire after announcing en $3.1billion bid
'I recognize dia luggage and dat na how I find out'
Wia dis foto come from, SE Ranking
Wetin we call dis foto, Tetiana Perebyinis bin dey work for one start-up for Silicon Valley
One man don tok about how e find out say Russian attack kill im wife and two pikin dem for Twitter wey show dia dead bodi.
Sarhiy Perebynis tell di New York Times say "I recognize dia luggage and dat na how I find out".
Tetiana Perebyinis and dia two pikin, Mykyta, 18, and Alisa, 9 die for di town of Irpin as dem bin dey try escape. For 2014, di family bin run comot eastern Ukraine to stay fo Kyiv on top di kasala dia between di Ukrainian army and Russian-backed separatists.
Serhiy bin dey take care of im mama wey dey sick before di war start.
And he tell di newspaper say e hear wiiinnn as e bin dey try enta Kyiv, dem force am go Russia to cross enta Poland.
E tell di Russian soldiers for di Poland borde say, "My whole family die for wetin you dey call special operation and we dey call war. Do as you like with me, I no get anytin to lose."
Serhiy write for Facebook for Russians sat wetin im face be like horror feem.
E write say "e dey hard to watch di wife wey you love dey lie down for black bag for ground".
E say also add, "I go go fight for dem to di end".
Seven pipo don die for Ukraine ontop overnight attacks
Wia dis foto come from, Reuters
Ukrainian officials don reveal say seven civilians don die from over night Russian attacks.
Four of di pipo wey die na pikin according to reports.
Authorities reveal say dem bin die for di Kharkiv and Sumy regions.
Officials say overnight attacks by Russia for Sumy region bin kill at least three pipo wey include one 13 year old boy and two women.
Reports say dem bomb residential area and gas pipeline for di area.
While for Kharkiv, four pipo die wey include two small pikin dem according to di Ukrainian State |Emergency Services.
Dem say di bombing for dat side bin hit a residential building near Kharkiv city just afta midnight.
Breaking, Four killed in shelling for south-east Ukraine: SES
Wia dis foto come from, Ukraine State Emergency Services
Four pipo dey reportedly killed - of which two na small pikin dem - after Russian forces shell one residential building near di city of Kharkiv for night, na so Ukraine State Emergency Services (SES) tok.
Di attack reportedly take place in di village of Slobozhanske, for south-east Ukraine.
SES add say dem also rush a five-year-old girl wey bin dey injured to hospital for treatment.
Rescuers dey expected to continue search operations today to pull bodies from di rubble.
Fire from bombardment also set a shopping mall ablaze for di heart of Kharkiv - however dem no report any casualties.
Russian advance don slow: Ukraine defence ministry
Di General Staff of di Armed Forces of Ukraine don post im daily morning update, wia e tok say di Russian advance into parts of Ukraine don slow.
Here na oda tins wey e tok:
Russia's advance for di direction of Kyiv don dey restrained
For eastern Ukraine, defense forces continue to deter di Russian offensive for Donetsk, Slobozhansky and parts of di Tavriya operational districts. Dem dey defend di cities of Kharkiv and Okhtyrka
For di south, di defense of di port city of Mariupol dey continue
Ukrainian forces don also fend off di Russian offensive for di directions of di cities of Kryvyi Rih,Mykolayiv,Voznesensk and di settlement ofNovovorontsovka(Kherson region)
Over di past two days, Ukrainian fighter jets and anti-aircraft missile units don destroy four Su-25 attack aircraft and two Russian helicopters
Di pace of di Russian offensive don dey slowed. Di number of cases of desertion and looting don increase wella
Di BBC neva independently verify di statement.
Di latest news from Ukraine
Wia dis foto come from, Getty Images
Una welcome. See wetin you need to know about wetin dey happun for Ukraine.
Di foreign ministers of Russia and Ukraine don land for Turkey to hold peace talks for di city of Antalya on Thursday
US Vice-President Kamala Harris dey Poland one day afta di US reject di kontri plan to transfer im jet fleet to di US, rather dan directly to Ukraine
White House officials son warn say Russia dey grow increasingly desperate, and fit resort to chemical weapons attacks against civilians in di coming days
US officials estimate say between 5,000 to 6,000 Russian troops don die so far in Ukraine
Ukraine President Zelensky say Russia bombing of one hospital for di city of Mariupol - wey destroy di maternity and children wards - na war crime
More private companies dey pledge to end business Russia, as di country economic isolation continue
Una good morning!
Una good morning.
Una welcome to our live coverage today of tori from around di world.
We go bring una tori from Nigeria, across Africa and di rest of di world.
Di world eye still dey Ukraine afta Russian invade dem.
Who be Olena Zelenska - Ukraine First Lady?
Russia 'destroy' Ukraine maternity hospital for 9 March attack
Nigeria President express sadness ontop Kebbi killings
Wia dis foto come from, President Buhari/Facebook
Nigeria president don extend sympathy to di family of di vigilante members wey bandits
brutally murder for Kebbi State northwest Nigeria.
“Dis egregious level of
criminality dey shocking”, Muhammadu Buhari tok for inside statement.
Oga Buhari say di killing dey
very very sad.
On Monday, 7 March, bandits
ambush di vigilante members for Sakaba/Wassagu Local Government Area of di
state.
President Buhari also assure Nigerians say im go do evritin to tackle dis kain palava.
Di Nigerian leader don direct
security forces to redouble dia efforts to frustrate di operational plans of terrorists
even before dem launch attacks.
Kebbi State command tok-tok
pesin, Nafiu Abubakar, wey confam di attack say dem neva fit ascertain di
number of casualties as dem still dey investigate di mata.
Buhari currently dey London for medical examination.