Evacuations from at least one city bin stop - reports
As we bin dey report, Ukraine and Russia don agree to hold 12-hour ceasefire for six cities for Ukraine today to allow civilians escape some of di heaviest fighting.
But we dey hear say no be all di planned evacuations of civilians dey happun.
For Izyum, eastern Kharkiv, one regional official dey claim say di evacuation of civilians dey "prevented by Russian shelling".
Oleh Synehubov say di explosions for suburbs mean say di evacuation convoys no fit leave.
For Mariupol, for south-east, di situation no too clear.
Ukraine foreign minister write on Twitter say Russia continue to block evacuation attempts and di delivery of humanitarian aid.
BBC no fit verify di situation for ground.
For Sumy, north east Ukraine, di picture dey quite different.
Pipo don fit leave di city for private cars and on bus since this morning, di city mayor tok.
And for Enerhodar, southern Ukraine, convoys of mainly women and children don begin leave, im mayor tok.














