Nigeria make history to win first Fifa U-17 Women World Cup afta beating Japan

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria U-17 team di Flamingos become World Champions afta dem beat Japan 2-1 for di Fifa Women World Cup for Morocco.
Di Flamingos, wey break record as di first African side to reach di final of di Fifa U-17 Women World Cup, set new record as dem win di trophy.
Afta dem miss plenti chances for di first half and sake of di fast game wey Japan dey play, flamingos no see beta chance score, even though dem lead wit 1-0.
Na for di 39th minute Awawu Bashiru score Nigeria first goal for di match, to put di Flamingos for early lead.
Di second goal come for di 47th minute, wen Oluebubue Umejiaku chip in di ball to beat di Japan goalkeeper Yamanaku.
Nigeria maintain di lead till around 80 minutes until wen Japan score goal to reduce Nigeria goal tally.
Japan bin dominate di first half of di game, but dem no fit meet up for di second half.
Dis na di first time di two kontris dey meet for global football for dis stage.
As e be so, Nigeria don enta history books as di first African team to win di Fifa u-17 World Cup.
Reactions for di U-17 World Cup win

Wia dis foto come from, Bola Tinubu
Nigeria President Bola Ahmed Tinubu don hail Nigeria Flamingos as dem bicom di first African kontri to win di under 17 Women World Cup
According to im statement e tok say na im wife bin dey follow di match.
E say "As di first lady Oluremi and me come back from wia we go fo for Akwa Ibon and Rivers states, I see am just dey ginger dey watch di Flamingos' World Cup final against Japan. Na ogbonge joy to see our girls defeat Japan 2-1 and bicom di first Africa team wey go carry di FIFA U-17 Women's World Cup trophy".
Former Vice President, Atiku Abubakar also hail di team say dem be inspiration to more girls to continue to dey pursue dia dreams wit confidence and courage.
"Captain Harmony Chidi bin tok about dream wey go make her teammates and kontri proud. I salute am, her teammates , Coach Akeem Busari and di entire technical and support staff for dis unforgettable achievement".
E add say, "thank you, Flamingos, say you give our nation dis moment of joy and unity. We dey very proud of una."
Meanwhile, NDC Presidential Candidate, Peter Obi for im reaction say "to our talented young stars, thank you say you carry our flag high and bring ogbonge joy to our kontri. Your ogbonge talent, resilience, hard work and dedication don give you special places for di hearts of Nigerians."
For FIFA President Gianni Infantino, e say "Congratulations to Nigeria for winning di Fifa U-17 Women World Cup 2026! As dem bicom di first African kontri to lift dis trophy, you don write ognoge ckapter for world football and bring ogbonge joy for your ontri wey love football".
Nigeria vs Japan match highlights
Second Half
Nigeria na di Fifa U-17 World Champions
90+4 Match don end.
90' Referee add four minutes.
85' Japan don increase di tempo of afta di goal wey dem score bin dey under review but dem don confam say na beta goal.
Japan 1-2 Nigeria
80' GOALLLLLLLLL for Japan
77' Di clock dey continue to tick as di final go soon end, nigeria wey lose dia first match na im dey play for final. Japan no lose any game for di group stage.
74' Japan still dey hustle to score but Nigeria no dey give dem chance.
70' Na about 20 minutes remain for Nigeria to complete di record wey dem don set as di first African team to reach di final, if dem win in di next 20 minutes, di record go change to be di first African kontri to win am.
65'Nigeria still dey lead while Japan dey struggle, e be like say di Japan players don tire.
60' Japan still dey try to break di Nigeria defence.
58' Freekick for Japan but notin come out, di ball go ova di bar!
55' Ova di bar!!! She fire di shot wide as she dey try to score Nigeria third goal.
54' Fine clearance from Oluwakemi Adegbuyi, by di sidelines di Japan player no see chance at all.
51' Nigeria no dey allow Japan play dia fast pace ball again as dem dey press di Japan defence.
Japan 0-2 Nigeria
47' Oluebube Umejiaku score Nigeria second goal, Flamingos dey see di World cup trophy like dis.
47' GOALLLLLLLLL for Nigeria
47' Substitutionnfor Japan Higuchi don comot Sato don enter
46' Second half don start

Wia dis foto come from, Judit Cartiel - FIFA/FIFA via Getty Images
First Half
45+ 2 Referee blow whistle, First half don end.
45+1 Throw-in for Japan, dem play beta throw but dem also miss chance to draw level wit Nigeria.
45' Referee add 1 minute
45' Freekick for Japan but dem play di ball wide without direction, di ball go out of play.
43' Nigeria dey push for anoda goal bifor half time go reach.
Japan 0-1 Nigeria
39' Di Japan goalkeeper punch di ball come out di first time, but she fire am again.
39' GOALLLLLLLL for Nigeria. Awawu Bashiru don score Nigeria first goal for dis match.
38' Freekick for Nigeria Yusuf Rodiat play am, e nearly enta net but Japan defence clear di rebound wey anoda player fire again.
36' Freekick for Japan but dem waste di chance as dem play am throway.
34' Japan dey dominate di midfield and Nigeria dey try catch up to but evritime di Flamingos make attempt to go front dem go lose di ball to Japan.
32' Japan and Nigeria dey try hard to break di defence but e neva work.
29' Corner kick for Nigeria dem play am but di Japan defence clear di ball from air.
27' Queen Joseph of Nigeria fire shot but di Japan defence stand gidigba.
26' Oluebube Umejiaku of Nigeria get clear chance to give nigeria di lead but she bin dey look for beta spot wen she miss di chance.
25' Japan play di corner kick but Nigeria defence cleat di threat.
24' Corner kick for Japan afta di Japanese play freekick and Nigeria head am go corner.
22' Japan player fall for ground afta tackle from Nigeria player but referee no reason am.
18' Japan cross ball go Nigeria goal area but di ball go wide as e no disturb Nigeria defence at all.
16' Nigeria don begin pick up and increase dia pace as dem dey try build from back with crosses.
14' Fine cross from Nigeria to di goal area of Japan but di ball land for Japan goalkeeper Yamanaka hand.
13' Japan dey use speed dey press Nigeria to open dia defence but e neva work.
11' Anoda chance for Nigeria Rodiat strike di ball but e no enta net.
10' Nigeria attack Japan, dem build up from di midfield but Japan defence no allow dem score.
9' Corner kick for Japan dem plam but notin come out.
6' Japan player pass long ball enta Nigeria goal area but defender clear di threat.
4' Nigeria start with pace but Japan neva allow dem hold ball.
1' Match don start

Wia dis foto come from, Judit Cartiel - FIFA/FIFA via Getty ImagesJoern Pollex - FIFA/FIFA via Getty Images




















