Minister of Power Tegbe break silence on cause of blackout for Nigeria

Nigeria National Grid
Published
Read am in 5 mins

Nigeria govment don blame one planned maintenance work for Egbin Power Station, shortage of gas supply plus sabotage of transmission lines as di main reasons why some parts of di kontri dey experience blackouts or epileptic power supply.

Egbin power station na Nigeria "largest" thermal power generating station for Lagos, wey dey supply about 16% of di total electricity on di national grid.

Di minister of power Joseph Tegbe for one statement on Saturday, tok say, "I dey aware say di current power outage don put plenty pressure on families and businesses for di four affected states, wey include Lagos and di Federal Capital Territory (FCT)".

E howeva assure Nigerians say electricity supply go improve within 48 to 72 hours as govment don begin work to address wetin dey responsible for di blackouts.

"My team and I dey work to return di affected generating units to service in phases, di first units go come back online within di next 48 to 72 hours.

"We also dey work wit operators to improve gas supply and accelerate repairs to di damaged infrastructure," e add.

Wetin dey cause power outages for Nigeria?

Minister for Power Joseph Tegbe wear one blue traditional wear and dey tok inside microphone

Some areas for Lagos, neva see power supply in weeks, while some wey dey see am tok say serious drop don dey for how dem dey get light.

Also, Nigerians don begin question wetin dey cause di prolonged blackouts, wey dem say di hot weather dey make increasingly unbearable.

One ogbonge Nigerian actor Kate Henshaw question why Nigeria, wey be giant of Africa go still dey struggle wit electricity for 2026.

However, oda factors wey di minister attribute to di power situation na limited of gas supplies to some thermal power stations and dat don reduce di amount of electricity wey di national grid get.

E also say say di reduced supply for some locations, particularly Lagos, na sabotage of transmission lines.

Tegbe tok say di ministry dey work to restore di affected generating units and improve gas supply to power plants.

"My team and I dey work to return di affected generating units to service in phases, di first units go come back online within di next 48 to 72 hours.

"We also dey work wit operators to improve gas supply and accelerate repairs to di damaged infrastructure," Tegbe add.

On 4 November, di minister bin order di Transmission Company of Nigeria (TCN), di Nigerian Independent System Operator (NISO) and electricity distribution companies (DisCos) to address di operational challenges wey dey responsible for di recent decline in power generation.

Niso for inside one separate statement bin attribute di shortage to decline in available power generation to inadequate gas supply to thermal plants and reduced water inflows into hydroelectric reservoirs.

"Shortage of gas supply don reduce how much power some affected thermal power stations fit generate, while low water level for reservoirs don also affect how much electricity hydro power stations fit produce.

"Sake of dat, di total electricity wey dey available for distribution don drop. Dis one don affect di amount of power wey dem allocate give Distribution Companies (DisCos) to supply customers. Na im make many areas dey get fewer hours of electricity, while load shedding and blackout don increase across different distribution networks. Di level of impact dey vary based on how much power dey available and di allocation wey each DisCo receive," Niso explain for di statement.

Even di Transmission Company of Nigeria add dia mouth inside di mata of light outage afta one of di DisCos bin blame dem for lack of light.

On Friday, dem tok say, "TCN say the claim wey Ikeja Electric (IKEDC) make say "grid instability" cause some recent power outages no correct.

"TCN explain say na only NISO get power to tok wetin really cause problems for di national grid, and NISO don alreadi explain say di main problem na lack of enough gas for some power plants and low water levels for hydro dams. Bicos of dis, less electricity dey generated and less power dey available for distribution."

Dem add say, "TCN say di outages no happen bicos transmission equipment spoil. According to di records, most of the interruptions happen because power generation reduce, while some odas happun because of issues on IKEDC's own network and because IKEDC no follow some load allocation instructions.

"TCN also point out say some feeders wey IKEDC mention, including MTN, Iju Water Works and Rack Centre, get faults from IKEDC network itself. For example, di Rack Centre outage on 2 November happun bicos of cable fault for IKEDC network, and na IKEDC workers repair am."

TCN say blaming them for power shortages wey come from low electricity generation dey give customers wrong information. Dem advise IKEDC and other DisCos to always use verified information from NISO when explaining power supply problems to customers."

Wetin govment say dem don do on top electricty mata for Nigeria

Signing di Electricity Act, 2023 on June 9 - Di act liberalise and deregulate di power sector, wey move am from di exclusive list so dat states and sub nationals go fit participate for power generation, distribution, and transmission wey states like Lagos, Enugu, Abia, Ekiti, Oyo, Kaduna and Niger dey take advantage of.

President Tinubu bin take ova N6 trillion legacy debt wey bin accumulate from 2015 to 2025.

E start di Presidential Metering Initiative to close di ova 7 million Metering gap.

Dele Alake add say in di last three years, ova 1.5 million customers don receive meter under di Presidential Metering Initiative.

Di Rural Electrification Agency don also connect universities, hospitals, and rural communities to solar power.

Di administration create N4 trillion bond programme to settle verified legacy debts to 21 power generating companies (Gencos) and gas companies (Gascos).

E say dem still dey fix di electricity market and power sector and President Tinubu neva comot one inch from im commitment.

Wetin Nigerians dey face be say, for some states and areas light dey, while some oda parts no dey too get light.

Di national grid still dey collapse up and down, for 2026 alone, e collapse pass six times and Nigerians still dey ask why National Grid dey collapse evritime

Nigeria for some areas dey use meter, while some pipo still dey use estimated billing.