Who be di 14 Nigerian-Americans win political positions for US midterm elections

Wia dis foto come from, UKEME JETER/ODUS EVBAGHARU/OLALEYE ONIKUYIDE/ESTHER AGBAJE/FACEBOOK/WEBSITE
Di US midterm election don confam majority win for di Democrats for both di house of representatives and di senate.
President Donald Trump bin lose control for di two places wia dem dey make laws for America.
Opposition party di Democrats bin win key states like Iowa, Texas, Ohio and Kansas; places wia Republicans dey win almost evritime bifor.
Di result mean say e go hard for President Trump to get im laws passed now sake of di Democrats get more power pass im own party to say gree or not.
But no be only house of representatives and senate pipo wey get positions afta dis midterm elections.
At least 14 Nigerian-Americans bin win for various states – dem secure positions for di legislature and local govment offices across many states.
Chairman of Nigerians for di diaspora commission Abike Dabiri-Erewa bin congratulate dis 14 winners inside one statement wey she release.
She describe dia victory as "reflection of di diaspora growing role for public leadership."
Dabiri-Erewa thru di statement bin commend di candidates for dia commitment to public service.
Tok-tok pesin for di Nigeria Diaspora commission (Nidcom) Abdure-Rahman Balogun list di 14 candidates wey e wish dem "impactful tenure".
List of di notable winners and dia positions
- Will Jawando, Montgomery County Executive for Maryland
Dem born Will "Yemi" Jawando for Silver Spring to Olayinka Jawando, Nigerian immigrant, and Kathy Jacob, wey be proud Kansan.
Im grow up for family wey struggle to meet dia needs but im rise thru di ranks . For 2018 dem elect am to di County Council at-large, wia im represent all 1.1 million residents at dat time.
For dat year, im take di oath of office for Strathmore wen im dey wear traditional Nigerian agbada to honor im heritage. Montgomery History now get di agbada for dia collection.
- Oye Owolewa, at-large member for di DC Council
Dr. Oye Owolewa na Pharmacist wey im be DC dia only districtwide elected office holder from East of di River.
Im dey represent pipo on top di DC Council at-large.
Dr Owolewa and im parents na Nigerian immigrants wey travel to Boston.
Im papa na from Kwara State wey im mama comot from Osun state.
Im dey advocate for immigration reform, income equality, campaign reform and healthcare.
- Junior Ezeonu, Texas House Representative for District 101
Dem born Junior Ezeonu for Onitsha, Nigeria wey im move to di state of Texas.
Di politician of Nigerian descent bin grow up for di US bifor dem elect am as di Grand Prairie City Council afta one run-off wia im defeat di incumbent wey bin dey dia for 12 years.
Im become di youngest-ever elected member for di council at 22 years at dat time.
Junior Ezeonu don retain im position, ova di years im dey help to reduce di Grand Prairie property tax rate wey im also raise di minimum wage for city employees.
Im also dey focus for affordable housing, transportation among odas.
- Olaleye Onikuyide (Connecticut)
Olaleye Onikuyide be lawyer wey bin grow up for West Hartford.
Dem born am to Nigerian immigrant parents wey bin enta di US for di early 1980s.
Olaleye get im undergraduate degree for di University of Hartford and im law degree from di University of Connecticut School of Law, later im become lawyer for 2024.
Olaleye dey represent West Hartford and Avon sake of im wan di community to remain "place wia pipo fit afford to live". Olaleye Onikuyide bin dey focus for affordability, strong infrastructure, and equality. Im latest victory mean say Olaleye be state Rep to represent di 19th district wey dey serve West Hartford and Avon.

Wia dis foto come from, WILL JAWANDO/OYE OWOLEWA/PHIL OLALEYE/JUNIOR EZOENU/FACEBOOK/WEBSITE
- Ukeme Jeter (Ohio)
Ukeme Awakessien Jeter bin win election as di state representative for Ohio house district 7. Ukeme parents na Nigerian immigrants from Ikot Obio Asangha, for di Nsit Ibom Local Government Area of Akwa Ibom State. Ukeme bin arrive for di US for 2000 and since den, she neva look back. For 2021, Ukeme ran for Upper Arlington City Council as first-time candidate. Dem bin elect her two times to di council by voters, for 2024 dem select her to serve as Council President and Mayor. Her focus areas include housing, childcare, energy and education. She say she dey use practical solution, real accountability, and leadership wey go deliver results for Ohio pipo.
- Odus Evbagharha (Texas)
"We do am" – Udus Evbagharu tok afta im win election to di Texas house. District 135. Im write on top im social media page say "families don send clear message say dem dey ready for change, lower coast, stronger public schools and govment wey dey work for us."
Odus na small business owner wey im be pickin of immigrants from Nigeria. "My parents enta dis kontri wit penny and promise, but now Texas pipo don speak dia mind." Di politician already bin made history for Harris County for 2021 when im become di youngest and first black leader for di Harris County Democratic Party. During his time as chair, Odus work to deliver di first democratic supermajority on di Harris County commissioners court since di 1970s.
- Carol Kazeem wey bin retain her Pennsylvania House seat
Dem elect Carol Kazeem as a Democrat to di Pennsylvania House of Representatives for di 2023 and 2025 terms. Di 34-year-old Pennsylvania state legislator get Nigerian heritage. She retain her seat for District 159. She bin dey work for di healthcare industry for 13 years.
- Phil Olaleye, Georgia House of representative
Dem bin first elect Phil Olaleye for 2022 to represent Georgia House District 59, wey dey serve part of Atlanta and East Point. Im now win three consecutive terms for im Georgia state house seat. Im defeat Republican opponent Sully Sullivan for dis midterm vote. Olaleye dey focused for job training, school funding for students wey dey poor, and di welfare of teachers. Phil na son of Nigerian and Colombian immigrants, wey dem raise am for Stone Mountain for Georgia. im dey stay for Summerhill wit im wife Sabrina Gomez Olaleye and dia two sons.
- Solomon Adesanya
Democrat Rep Solomon Adesanya na di Georgia state house representative for District 43 wey involve Marietta and Northwest Atlanta regions. Solomon bin win im 2022 primary race for di Georgia House of Representatives for di 43RD District wit 57% of di vote. Im later win di general election wit 56% of di vote, for 2024, im run unopposed. Im papa enta di US from Nigeria for 1970 to pursue education. Adesanya na community advocate wey dey committed to improve quality of life of pipo and providing opportunities for every Georgian. Im say im go fight for di community to make sure everyone get di chance to achieve di American dream.
- Esther Agbaje, Minnesota House
Esther Agbaje dey serve as di Minnesota State Representative for District 59B wey dey represent di heart of Minneapolis. Both of her parents bin enta di US from Southwest Nigeria for higher education. Her papa comot Ekiti State wey her mama comot Ogun State. Esther don serve for di Minnesota House of representatives for ova five years; she bin enta di office for January 2021.She be lawyer, negotiator and public servant wey dey focused for policies wey put pipo first ova profit. As legislator, her priorities na affordable housing, economic opportunity and environmental justice.
Di rest na:
- Segun Adeyina win District 110
- Justin Onwenu, Michigan
- Janelle Anyanonu, New Mexico
- Gabe Okoye




















