At least seven pipo kpai and several odas injure as trains collide for Egypt
- Author, Emer Moreau
- Published
- Read am in 3 mins
One train crash near di Egyptian city of Giza don lead to di death of at least seven pipo and ova 100 pipo injure, di health ministry announce.
Egypt railway authority tok say di train bin dey travel from Giza to Fayoum, south of Cairo, wen e crash into anoda train wey dey go south from Cairo to Aswan.
Fotos from di scene show as plenty carriages don comot from di rail line and fall for side of di road.
Egyptian health ministry say dem don send at least 72 ambulances, while local media report say one train driver dey among di pipo wey kpai.
E neva dey clear wetin cause di accident.
Egyptian President Abdul Fattah al-Sisi say im dey follow di incident wit "great concern" and e extend im "deepest condolences to di families of dos wey lost dia lives".
"I don direct state agencies to provide di necessary medical care, promptly investigate di circumstances of di accident, and hold accountable anyone dem see say dey negligent," e write on X.
Di govment say dem don put hospitals for di area "on heightened alert" as dem dey handle di massive influx of patients.
End of Di one wey oda users dey read well well
BBC Arabic report say dem don suspend train service between Gizu and Upper Egypt.
Egypt public prosecutors don launch formal investigation into di train collision that wey kill at least seven pipo.
For inside one statement on Facebook, di Public Prosecution Office tok say dem go work to determine di circumstances wey cause di crash.
Investigators go examine di damaged carriages, tracks, surrounding area and work to identify any "shortcomings" in operational procedures and safety measures, di statement add.
Di collision occur for di area between Kafr Ammar and Al-Raqqa stations for Al-Ayyat.
Di rail authority dispatch emergency teams and cranes go di scene.
Di site of di Sunday accident for Al-Ayyat, for Egypt Giza governorate, get long history of rail disasters.
Na di location of Egypt deadliest train tragedy.
For February 2002, one fire bin engulf one passenger train wey bin dey travel from Cairo to Luxor.
Di train continue for around nine kilometres bifor e halt. More dan 370 pipo kpai according to officials, although some estimates put di toll considerably higher.
Two further crashes for di area for 2009 kill dozens more.
Fotos from di crash

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

























