Ronaldo retire from Portugal duty

Cristiano Ronaldo playing for Portugal
Wetin we call dis foto, Cristiano Ronaldo won Euro 2016 with Portugal
    • Author, Mike Peter
    • Role, BBC Sport journalist
  • Published
  • Read am in 4 mins

Portugal legend Cristiano Ronaldo say e dey retire from international football.

Di 41-year-old forward don score 146 goals and win 234 caps for im kontri - both world records - since making im debut for 2003.

E waka out of di Portugal camp for September afta dem tell am e no go start di Nations League match against Denmark.

"To di Portuguese pipo, di day don come for me to hand back di number seven shirt of our national team," Ronaldo say for Instagram video.

E don dey play for Al-Nassr for di Saudi Pro League since 2022 and na di best-paid player in football history with an annual salary of £177m.

Wetin Ronaldo tok about im retirement

"I neva feel e belong to me alone, but for 23 years I get di privilege and responsibility of wearing am, defending am and carry am wit me into stadiums all around di world.

"Today di time don come to pass on to di future. No be easy decision, becos some decisions no dey made wit di mind alone - dem be also made wit di heart.

"A journey wey begin for August 2003 and changed my life foreva don come to an end."

On Friday Portugal dey set to announce dia squad for November Nations League fixtures - against Denmark at home and Wales away.

Di Portugal Football Federation say refuse to "let dis farewell take place without due tribute".

Di statement read: "na our firm and immense desire to organise, plan, participate and actively collaborate for wat will always be fitting tribute to Cristiano Ronaldo immense career, in which fans and di kontri fit applaud and celebrate, once again, di player wey don give us so much."

Cristiano Ronaldo football career

Ronaldo great rival and Argentina legend Lionel Messi retire from international football in October.

Ronaldo spend nine successful years for Spain playing for Real Madrid, winning La Liga two times and lifting di Champions League four times before joining Italian side Juventus for 2018.

Earlier dis year, Cristiano Ronaldo become co-owner of Spanish second division side Almeria afta e acquire 25% share for di club.

Ronaldo search for record 1,000 career goals don kontinue. and don return to training in Saudi Arabia wit Al-Nassr.

E don score ova 900 goals for Portugal, Sporting, Manchester United, Real Madrid, Juventus and Al-Nassr.

Di main tin wey dey drive on now na hoping to reach unprecedented 1,000 career goals - e currently dey 985.

Ronaldo journey for football na sweet one wey dey totori plenti pipo.

Afta 31 first-team game and five goals for Sporting, Ronaldo catch di eye of Manchester United for pre-season friendly for 2003, setting up two goals for 3-1 win for Lisbon.

Five days later e join di Red Devils for £12m.

Ronaldo win di FA Cup for im first season for United, scoring in di final against Millwall.

But na di 2006-07 wey im career really explode. E hit 17 Premier League goals, im first season of double figures, dem name am player of di year and young player of di year - and win im first league title.

Di following season dey even better, winning im first Champions League - scoring in di final - im first European Golden Shoe for top scorer, and anoda league title.

Ronaldo score 118 goals for 292 games for im first spell at United, and one was ranked above all the others.

Months later, Ronaldo join Real Madrid for £80m.

Ronaldo first season for Real Madrid produce no trophies and im second see am win di Copa del Rey won.

Ronaldo, den 30 years, score 3-0 La Liga win ova Levante for October 2015 to become di club all-time top scorer wit im 324th goal in 310 games.

Di 2015-16 campaign go on to be di sixth season for row wia Ronaldo score 50 or more goals for all competitions.

Ronaldo end up extending dat record by 126 goals - leaving Real wit 450 goals for just 438 games.